Government Science College, Kagara, kidnap update: Buhari deploy soldiers, Governor close down school, Senate demand State of emergency.
Tori As We Dey Waka Come: Di President of Nigeria, Muhammadu Buhari order di military and police for immediate and safe return of di staff and students armed bandits kidnap from Government Science College, Kagara, for Rafi Local Government Area of Niger state. Benjamin M. Idoma na di name of di student wey di bandits kill. 650 students na im dey di school. Dem kill Benjamin in di presence of other students and staff, as e dey try escape from di school. Niger State Governor, Alhaji Abubakar Sani Bello wey announce di closure dis morning insist say goverment no go pay any ransom to secure di release of anybody wey dem kidnap, say instead dem go use di money take buy ammunitions. Niger State government go review di villages for di state by bringing pipo wey dey live for small communities come big towns wey dey near dem so dem fit provide security for dem until security for di area dey restored. For inside statement by di Senior S...