Posts

Government Science College, Kagara, kidnap update: Buhari deploy soldiers, Governor close down school, Senate demand State of emergency.

Image
Tori As We Dey Waka Come: Di President of Nigeria, Muhammadu Buhari order di military and police for immediate and safe return of di staff and students armed bandits kidnap from Government Science College, Kagara, for Rafi Local Government Area of Niger state. Benjamin M. Idoma na di name of di student wey di bandits kill. 650 students na im dey di school. Dem kill Benjamin in di presence of other students and staff, as e dey try escape from di school. Niger State Governor, Alhaji Abubakar Sani Bello wey announce di closure dis morning insist say goverment no go pay any ransom to secure di release of anybody wey dem kidnap, say instead dem go use di money take buy ammunitions. Niger State government go review di villages for di state by bringing pipo wey dey live for small communities come big towns wey dey near dem so dem fit provide security for dem until security for di area dey restored. For inside statement by di Senior S...

Oyo state Ibadan: Yoruba vs Hausa clash inside Shasha.

Image
Tori As We Dey Waka Come: For statement wey di chief press secretary to Governor Seyi Makinde, Mr. Taiwo Adisa, drop, im say dem set di curfew make law and order no dabaru for di area as dem also set for Shasha and di market area. Di curfew time go be from 6pm to 7am. Dis na videos of some place for Shasha. Di popular Shasha Market, for Ibadan, Oyo state South West Nigeria after youths from both di Hausa and Yoruba communities fight. According to local tori pipo, na misunderstanding start di mata and na so di two tribes start fight. Inside Shasha 50 shops and plenti goods and property don spoil finish, before security waka come. Dem even tiff from some shops & houses. Oyo state governor Seyi Makinde don order curfew for di area Di Oyo State government don order di sharpaly closing of Shasha market for Akinyele Local Goment Area of Ibadan. Inside di statement, dem drag ear give warning to residents for di area say make dem run dia legal and legit business peacefully, as dem add say...

Di full videos and Tori about Today waka for Lekki Toll Gate protect.

Image
Tori As We Dey Waka Come: Dem don arrest Popular Nigerian comedian, Debo Macaroni and oda Nigerians wey bin dey "pass" Lekki tollgate, venue of planned protest by protesters. Mr macaroni go live on him phone inside van. Debo Macaroni a.k.a Mr macaroni as dem put am inside van. Dem don collect all di pipo phone inside van.  Him yan say, based on democracy and freedom of waka go any where go talk, as im be Nigerian wit rights to go anywhere im feel like," police still throw am inside dia van alongside oda pipo wey dem bin don arrest. Di comedian bin go live for Instagram to tell "di world how police dey abuse human rights for Nigeria." During di live, Macaroni tok about how im bin dey go about im normal business before e come decide to go di protest venue to "see tins for himself. wakacometv.blogspot.com send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or whatsapp +2348133385379. As We Dey Waka, No Be Lie. #wakacometv #toriaswedewakacome

Gunshots inside Obalende: Today di rival groups of NURTW clash inside Lagos.

Image
Tori As We Dey Waka Come: picture on top of obalende bridge, as pipo dey run. Di Tori be say, Plenty pipo dey run, when dis wahala happen for around Ken Salem House. Wahala for who no sabi run, as agbero plenty wey dey parra, early mo mo around 8am today, wey be Thursday 11th of February 2021. Na so pipo dey run, as dem see agbero wey plenty with gun, as dem dey shot dey scatter every thing, no be small wahala happen today inside obalende, dis fight na between di rival groups of the NURTW, wey dem dey call, National Union of Road Transport Workers. Inside dis matter, plenty shop don skater and some pipo get injury as dem dey try run for safety. Dis na di video... https://youtu.be/KZ2LEhjw9W4 Gunshots clash in obalende wakacometv.blogspot.com send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or whatsapp +2348133385379. As We Dey Waka, No Be Lie. #wakacometv #toriaswedewakacome

Nickelodeon Kids Choice Awards (KCA): Don nominate Emmanuella and Ikorodu Bois.

Image
Tori As We Dey Waka Come: Emmanuella and Ikorodu Bois Di International awards wey dem dey call di Nickelodeon Kids Choice Awards (KCA) don drop dia 2021 nominees list wey dem add we Nigerian talented pikin put inside,dis one make plenty African pipo happy well well, as Dis year nomination get pipo like Ikorodu Bois, Emmanuella, Elsa Majimbo, Bonang Matheba, Mo Salah, Master KG plus GhettoKids and more. Di competition dey tough for di Favourite African Social Media Star award wey some veterans and some fresh face wey ginger pipo all ova di world. Celebrity Actor, comedian, Saturday Night Live legend — with Kids' Choice Award winner! — Kenan Thompson, go host di show wey go waka come on March 15 wey go be Monday 2021. All fans fit waka home to votes on top Twitter and also online for www.kidschoiceawards.com, and for Screens Up app wey dey work for iPad, iPhone, and Android devices for inside U.S.A Di African celebrities plus fans go dey ...

Lekki Toll Gate: Nigerian Youths Say, No Justice No Reopening

Image
Tori As We Dey Waka Come: Di Tori be say since di October 2020 Lekki shooting wahala, dem don stop to dey collect money, sake of di katakata wey bin happen. On Monday 8 February 2020 for Lagos state, officials of Lekki Concession Company for Lagos show face for di toll gate area. Di reopening of Lekki toll gate for Lagos State don make make many Nigeria youths to hala afta di state judicial panel wey dey investigate di shooting incident wey happenn dia give di company wey dey manage di place green light to take control. Plenty pipo dey para, dey vex well-well for dis waka wey di Judicial panel take, onto say dem neva reveal information on dia findings on di Lekki toll gate incident wey happen last year. During Di end sars shooting for Nigeria last year, October 2020, against police brutality for Lekki toll gate wey be di commercial road for Lagos, don lead to Nigeria condemnation across di world. As di matter dey sup so, Hope bin dey say di judicial inquiry set up to...

Sex Wahala: With Dis Drink, No Wahala For Married Pipu.

Image
Tori As We Dey Waka Come: Tiger nut drink fit wake up your sex drive - Nutritionist Sex drive wahala na one thing wey dey bring plenty palava between man and woman. People wey sabi say e dey common dis days among young people pass as e no dey like before wen people think say na only old people wey dey suffer am, sake of say dia body don weak. Di mata dey very serious as many people wey get dis problem dey die in silence because say dem dey shame to talk am for outside. But e get one drink wey dey common wey dey help people wey get dis kain problem. Di ingredients sef no dey cost plenty money and person fit make am for house. Tiger nut. Hausa dey call am 'Aya', Yoruba dey call am 'Ofio' and Igbo dey call am 'Aki Hausa', and another name for am na Hausa groundnut. OGA KD, Chief Executive Producer (CEO) of Reis Dipo Film & WakacomeTv, for one event talk say Tiger nut drink go help man pikin wey done mary do well for bed, him talk...

CBN bans cryptocurrency: Davido and plenty pipo dey parra on top dis matter.

Image
Tori As We Dey Waka Come: Davido express shock and say dis matter na just three days afta im bin tell all him fans on twitter about plans to go into cryptocurrency "Wooooooow only took 3 days" Davido tweet  Central Bank of Nigeria, don yan why dem place restrictions on top cryptocurrencies for all banks wey dey di Nigeria. Dem yan am inside statement wey di Acting Director, Corporate Communications Osita Nwanisobi sign on Sunday evening, di Apex bank for Nigeria say dem don already forbid all commercial banks wey dey di kontri from trading or transacting since 2017. CBN mention say some oda kontries like China, Canada, Taiwan, Indonesia, Algeria, Egypt, Morocco, Bolivia, Kyrgyzstan, Ecuador, Saudi Arabia, Jordan, Iran, Bangladesh, Nepal and Cambodia, don ban dis cryptocurrenecy trading sake of say dem fit dey use am for financing terrorist, launder money and do some kain bad things. Apex bank for di kontri however assure s...

Nigerian Army: Di Secret Execution of 6 Igbo People, Na Fake News

Image
Tori As We Dey Waka Come: Nigerian Army waka yan on top twitter, say that tori for twitter na 'fake news. Dem say na fake news, of di matter wey sup say dem do one "secret execution of 6 Igbo Christian soldiers" on 25 January 2021. For dia report, local tori pipo News Express claim say dem torchlight di report by one human rights group wey accuse di Nigerian Army of di "secret execution of 6 Igbo Christian soldiers" on 25 January 2021. Tori wey waka comot on Tuesday be say di name of di 6 soldiers na - Prince Ukwuoma, Ebube Isaiah, Amos Azubuike, Ekene Ebere, Moses Anyim and Godwin Uchendu, dem bin dey based for di Abacha Barracks, Abuja. Dem say na ethnic cleansing di Nigerian Army use di soldiers do because of dia tribe (Igbo) and dia religion (Christian). Nigerian Army on dia official Twitter handle don declare say di tori no be true, after dem write "Fake News!!!" ontop screenshot of di News Express tori for Twi...

South-East don Ban Cows, make dem no dey waka again for road.

Image
Tori As We Dey Waka Come: South east Ban Cows by foot: No more Open Grazing, Umahi explain why dem ban movement of cows by foot. South-east governor don ban open grazing, di Chairman Southeast Governors' Forum, David Umahi don confirm. Governor Umahi of Ebonyi say di South-east zone ban open grazing of cattle inside dia areas Na during one APC stakeholder meeting for Christian Ecumenical Centre Abakaliki, di Ebonyi State Governor announce dis mata. Di South-east Governors' Forum also ban di movement of cows by foot into di zone and beg leaders to show loyalty to Nigeria alias patriotism for dia conduct to guarantee di unity of di kontri. Governor David Umahi say: "We dey live in a dangerous time, without patriotism to our nation Nigeria, e dey very difficult to get a peaceful time" Make leaders and stakeholders of di zone to speak up and avoid playing politics with di Security of di zone and nation. "Governors of South-east don dey cal...

Pavilion Hotel Ayepe: Hotel wey dey look pipu naked inside room.

Image
Tori As We Dey Waka Come: Pavilion Hotel Ayepe: Hotel wey dey look pipu naked inside room. Nigerians don begin react to one video wey show face for internet wey claim say one hotel for Ogun state hide cameras for inside di rooms wey guest dey lodge. Dem also warn pipo to dey careful of di kain hotel dem go dey lodge. Di pipo wey dey dis video, para for di hotel management, why dem go install camera inside di rooms. Di men wey dey para for di video say dem discover say dem hide di camera inside Air Conditioner for dia rooms. Dem talk say di camera don record all dia family naked body. Nigeria Hotel Association say dem still dey torchlight di mata and dey try find out di particular hotel wey di thing take happun. Oga Akpovwovwo say hotels "fit install cameras for di corridor, staircase, back of di hotel but for inside rooms e dey wrong." installation of cameras for inside guest rooms dey very wrong, na invasion of guest privacy and e dey devili...