Posts

Kaduna state: Armed bandits don burn down the building of di Holy Family Catholic Church.

Image
Tori As We Dey WakaCome:  Armed bandits don burn down the building of di Holy Family Catholic Church, and two homes, inside Kikwari village, Kajuru local government area for Kaduna state. Samuel Aruwan, Commissioner, Ministry of Internal Security and Home Affairs, Kaduna State, talk on Sunday, say pipo run com or for di area when di gbege start, as dem receive information say bandits dey outside di village. Di armed bandits burn di church and two houses. Di Governor El-Rufai feel very bad, him talk say him go use him office to give protection and hellep to provide for di pipo and continue to work hard to fight against banditry and other crimes. Him tell worshippers to remain strong in their faith and devotion, and to see dis as an act perpetrated by enemies of peace, humanity and diversity wey no go succeed but will be defeated by the grace of God. Di Governor don direct di Kaduna State Emergency Management Agency to urgently assess the damage done...

BELLO AMBASSADORS NETWORK, (BAN)

Image
BELLO AMBASSADORS NETWORK, (BAN) www.ban2023.org E sweet us for belle as we don waka come with ogbonge network for the Nigerian youths for we kontri Nigeria, from six (6) geopolitical zones and thirty-six (36) states for we federation. Dis na non-governmental Organisation with common agenda to fit copi di leadership and charitable character of Governor Yahaya Bello of Kogi State. Dem dey support to helep we pipu wey need urgent help to support dem as Governor, and Yahaya Bello dey promote quality leadership. As the youngest Governor for Nigeria, Yahaya Bello don do better waka and him build cabinet of young Nigerians sote e no even look tribe, gender and religion. The ogbonge waka of Governor Yahaya Bello for areas of Education, Healthcare, Agriculture, Security and Infrastructure reach something wey we suppose dey give national recognition for. We don see courage, intelligence and love of every Nigerian for inside Governor Yahaya Bello with the wey him be dey c...

Breaking News: Military aircraft don crashes inside Abuja.

Image
Tori As We Dey WakaCome:  Di matter happen today wey be Sunday 21st of February 2021, Nigeria Military aircraft crashes for Abuja. Hadi Sirika wey be di Aviation Minister, confirms di crash of military aircraft King Air 350 close to Nnamdi Azikiwe International Airport Abuja. E talk say di aircraft crashed “short of our Abuja runway after reporting engine failure enroute Minna” Sirika say di air crash “bin dey fatal” but make we kontri pipo dey calm down for we military to investigate di matter. see di video: wakacometv.blogspot.com send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or whatsapp +2348133385379. As We Dey Waka, No Be Lie. #wakacometv #toriaswedewakacome

School Girl Wey Carry Gun Enter School To Kill Teacher, Don Confess

Image
Tori As We Dey WakaCome: The secondary school girl for Ikot Ewa community, for Cross River State don come out to confess say, she na cultist for one girls confraternity, for CRS, wey dem call themselves "Sky Queen Confraternity." The girl wey dem identify as Promise Idorenyin, na 17 years old, dem   arrest her last week for one Community Secondary School for Ikot Ewa inside Akpabuyo local government area of Cross River State, after she bin try to shot one of her subject teacher with one local made pistol, wey she bin later confess say na one of her married man friend wey dey totori her body, give her. Dem still dey interrogate the girl for further inquiry of the supposed confraternity wey she mention during her confession, to know which other students and teachers wey dey at risk for that same school wey she dey attend. send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or whatsapp +2348133385379. As We Dey Waka, No Be Lie. #wakacometv #toriaswedewakac...

Secondary School girl cari gun go school to shoot her class teacher

Image
Tori As We Dey Waka Come: Government Secondary School girl cari gun go school to shoot her class teacher wey tell her to barb her hair. Dis Government Secondary School girl carry one local made gun enter School for Akpabuyo, Ikot Ewa Cross River State to shoot her teacher because im tell her to cut hair hair. Dis matter happen for Community Secondary School Ikot Ewa for Akpabuyo, Cross River State, last week Thursday. E happen say, as di young girl resume school, her class teacher tell am say make she go barb her hair wey she carry come school. Dis na becos, so school for Cross River, students no dey carry grown hair come school as dem get dat kind rule, she gast go back house. Di next day she waka come school wit local gun. Di School Principal raise alarm. Pipo around come hold her and teachers, students all come out to see wetin dey sup for school. One person wey see as di matter happen yan say  im go visit im friend wey dey stay close to school wen dem h...

Commander Hisbah Arrested: Dem Don Catch Islamic Police Oga for Hotel with Woman.

Image
Tori As We Dey Waka Come: Di officer wey dey in charge of arresting prostitutes and beggars for Kano, Hisbah Sani Uba Rimo dey inside serious gbege after police arrest am on Monday for hotel. Police dem bin get report from one man say di Hisbah OC dey invite im wife to one hotel for Sabon Gari area of Kano city were him and di woman dey meet. Just After di arrest, Hisbah suspend officer Sani from work pending investigations dis na after di oga kpata kpata commander general Sheik Harun Ibn Sina form five man committee to investigate wetin happen. Kano Police Command confam say di husband of di woman don come forward to gree say di Hisbah OC na actually im in-law and dey try settle issues between dem. According to tok tok pesin DSP Abdullahi Haruna di whole thing don dey resolved and di Hisbah oga no get case to answer. wakacometv.blogspot.com send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or whatsapp +2348133385379. As We Dey Waka, No Be Lie....

Abuja Biggest Entertainer, CEO of ND Motors, A.K.A ABig Nwamama, with him Album launch

Image
Tori As We Dey WakaCome: We dey waka come with Abuja biggest entertainer,  CEO of ND Motors, A.K.A ABig Nwamama, with him Album launch this Saturday. 20th of February 2021. Picture of Album Banner. Interview by DirectorKD: DirectorKD: Na who be Abig Nwamama? Nwamama: I be Power Bike engineer, I dey sell power bike and I dey do my music, I love music and my best sport na Bike race, I be cool and loving person, I love to entertain people with my bike and music. DirectorKD: we go like ask you about this your album, na wetin carry you waka to make this songs? Nwamama: I get plenty songs wey I don record, plus musical video wey I don shoot, so I say make I drop my album this Saturday wey go be 20th of February 2021, Inside this album we go see say I also want to help pray for Coronavirus make E waka go, I get song wey I also shoot the video with plenty power bike, Oyele and so many song wey I record as e dey hot. DirectorKD: tell us about your album, na wey dey come and how ...

Government Science College, Kagara, kidnap update: Buhari deploy soldiers, Governor close down school, Senate demand State of emergency.

Image
Tori As We Dey Waka Come: Di President of Nigeria, Muhammadu Buhari order di military and police for immediate and safe return of di staff and students armed bandits kidnap from Government Science College, Kagara, for Rafi Local Government Area of Niger state. Benjamin M. Idoma na di name of di student wey di bandits kill. 650 students na im dey di school. Dem kill Benjamin in di presence of other students and staff, as e dey try escape from di school. Niger State Governor, Alhaji Abubakar Sani Bello wey announce di closure dis morning insist say goverment no go pay any ransom to secure di release of anybody wey dem kidnap, say instead dem go use di money take buy ammunitions. Niger State government go review di villages for di state by bringing pipo wey dey live for small communities come big towns wey dey near dem so dem fit provide security for dem until security for di area dey restored. For inside statement by di Senior S...

Oyo state Ibadan: Yoruba vs Hausa clash inside Shasha.

Image
Tori As We Dey Waka Come: For statement wey di chief press secretary to Governor Seyi Makinde, Mr. Taiwo Adisa, drop, im say dem set di curfew make law and order no dabaru for di area as dem also set for Shasha and di market area. Di curfew time go be from 6pm to 7am. Dis na videos of some place for Shasha. Di popular Shasha Market, for Ibadan, Oyo state South West Nigeria after youths from both di Hausa and Yoruba communities fight. According to local tori pipo, na misunderstanding start di mata and na so di two tribes start fight. Inside Shasha 50 shops and plenti goods and property don spoil finish, before security waka come. Dem even tiff from some shops & houses. Oyo state governor Seyi Makinde don order curfew for di area Di Oyo State government don order di sharpaly closing of Shasha market for Akinyele Local Goment Area of Ibadan. Inside di statement, dem drag ear give warning to residents for di area say make dem run dia legal and legit business peacefully, as dem add say...

Di full videos and Tori about Today waka for Lekki Toll Gate protect.

Image
Tori As We Dey Waka Come: Dem don arrest Popular Nigerian comedian, Debo Macaroni and oda Nigerians wey bin dey "pass" Lekki tollgate, venue of planned protest by protesters. Mr macaroni go live on him phone inside van. Debo Macaroni a.k.a Mr macaroni as dem put am inside van. Dem don collect all di pipo phone inside van.  Him yan say, based on democracy and freedom of waka go any where go talk, as im be Nigerian wit rights to go anywhere im feel like," police still throw am inside dia van alongside oda pipo wey dem bin don arrest. Di comedian bin go live for Instagram to tell "di world how police dey abuse human rights for Nigeria." During di live, Macaroni tok about how im bin dey go about im normal business before e come decide to go di protest venue to "see tins for himself. wakacometv.blogspot.com send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or whatsapp +2348133385379. As We Dey Waka, No Be Lie. #wakacometv #toriaswedewakacome

Gunshots inside Obalende: Today di rival groups of NURTW clash inside Lagos.

Image
Tori As We Dey Waka Come: picture on top of obalende bridge, as pipo dey run. Di Tori be say, Plenty pipo dey run, when dis wahala happen for around Ken Salem House. Wahala for who no sabi run, as agbero plenty wey dey parra, early mo mo around 8am today, wey be Thursday 11th of February 2021. Na so pipo dey run, as dem see agbero wey plenty with gun, as dem dey shot dey scatter every thing, no be small wahala happen today inside obalende, dis fight na between di rival groups of the NURTW, wey dem dey call, National Union of Road Transport Workers. Inside dis matter, plenty shop don skater and some pipo get injury as dem dey try run for safety. Dis na di video... https://youtu.be/KZ2LEhjw9W4 Gunshots clash in obalende wakacometv.blogspot.com send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or whatsapp +2348133385379. As We Dey Waka, No Be Lie. #wakacometv #toriaswedewakacome