Posts

President Buhari yan on top di Terror wahala inside Abuja

Image
Tori As We Dey WakaCome: Nigerian President Buhari don react on top di terror alart inside Abuja, BuBu yan say make una no fear say di US and UK advice to dia pipo no call for panic. Nigeria President Muhammadu Buhari say di terror alert by di foreign kontris no mean say attack go happun. Nigeria leader reaction dey come as some kontri bin first issue terror alert say threat of terror attack dey for Abuja. Bubu yan for statement wey im tok-tok pesin, Garba Shehu release on Friday say im don charge security operatives to dey alert since afta di attack on Kuje prison. “No be only Nigeria dey di list of terror threats by foreign goment travel advice to to dia citizens. UK and US travel advisories also tok of  terror attacks wey fit happun for many Western European nations. “However, e no mean say attack go happun for Abuja,” di statement tok. As we dey waka, no be lie. send your Tori to we Email: wakacometv@gmail...

Flood water kill pipu for Yenagoa, di Bayelsa State capital inside Nigeria

Image
Tori As We Dey WakaCome: How di death of 16 year old Temedi  Yerimene wey drown becos of flooding for Igbogene community for Yenagoa, di Bayelsa State capital, Southern Nigeria na one of di major losses pipo dey count for di flood palava Nigeria dey suffer so. Di boy na from Amabulu in Ojobo community of Ekeremor LGA of Bayelsa but di family dey live for Igbogene. Tori be say di flood push di young boy into di deep canal for di area wen im and im friends go swim for di flood water close to di Bayelsa Ecumenical Centre. Mama of di boy, Yerimene Waka Come yan say di incident happen on Monday 10 October 2022 around 11am in di morning wen im go swimming. "I come back from market and dem tell me say im go swim. I bin think say im go swim for di water wey dey flood for our compound until one of im friends tell me say na di flood drag am into di canal." Efforts by di community search party wey go search for di boy no dey...

Obi waka on top presidential matter

Image
Tori As We Dey WakaCome: Today wey bi Saturday, Naim Labour Party’s presidential candidate, Peter Obi start their own campaign sake of the February 2023 wey dey come for front.  Dem start am for inside Lafia, the Nasarawa State capital in the North-Central geopolitical zone of Nigeria. Him running mate, wey be Datti Baba-Ahmed; and National Chairman of the Labour Party, Julius Abure; and other 1,234 members of the party campaign council land gidigbam for the venue of the rally on Saturday around 11am. As we dey waka, no be lie. send your Tori to we Email: wakacometv@gmail.com Follow us on top Instagram @wakacometv Follow usom top twitter @wakacometv Follow us on top Facebook @wakacometv

Naira note matta never clear

Image
Tori As We Dey WakaCome: Minister of Finance, Budget and National Planning, Zainab Ahmed, don come reject the plan wey Central Central Bank of Nigeria (CBN) bring come out to redesign our naira, as she come dey cut warning dey give CBN say if e happen ehn, E go do 'ntoor' to our economy wey don already keep face like 'fowl wey rain beat' She blame CBN say dem no consult Finance Ministry first before dem take di decision.. As we dey waka, no be lie. send your Tori to we Email: wakacometv@gmail.com Follow us on top Instagram @wakacometv Follow usom top twitter @wakacometv Follow us on top Facebook @wakacometv

CBN New Naira note waka

Image
Tori As We Dey WakaCome: One Former Deputy Governor of the Central Bank of Nigeria (CBN), Kingsley Moghalu don come out dey yarn, say that decision of CBN to redesign the naira note make sense die, say na good step for our economy. He still shalaye, say CBN dey try to control the supply of money inside the economy.  See as he talk... ''If 80% of bank notes inside circulation dey outside bank, na wahala be that.  Wetin CBN dey plan, na to force all those akpalakpala wey dey outside, make e enter back inside bank. Those wey hold money must surrender to get new ones or else e go become illegal tender after January 31 2023. As we dey waka, no be lie. send your Tori to we Email: wakacometv@gmail.com Follow us on top Instagram @wakacometv Follow usom top twitter @wakacometv Follow us on top Facebook @wakacometv

Lugbe Abuja Estate

Image
Tori As We Dey Waka Come: Trademoore estate Lugbe, No be news again say no be small High Powered Sting Operation naim bin shele in Phase 3 this afternoon, wey make dem shut down the estate completely. Joinbody of DSS team and other team also put body for this level. We bin no get the full details of the reason(s) why the operation bin happen, but report bin dey about allegate of terrorist activities.  From our side, wey dey inform everybody to dey vigilant, KNOW YOUR NEIGHBOURS and report any kurukere movement, person or activities wey u no understand to Police, the Exco and Street Reps. Finally, make  we dey calm and continue to dey do our everyday activities within the Law. God bless and protect us all. As we dey waka, no be lie. send your Tori to we Email: wakacometv@gmail.com Follow us on top Instagram @wakacometv Follow usom top twitter @wakacometv Follow us on top Facebook @wakacometv

Make your Dream Alive

Image
ARE YOU AN Actor/Model/Dancer/Comedian/ Musican? COME LET MAKE YOU GLOBAL STAR  ✔INSTAGRAM MARKETING, ✔ FACEBOOK MARKETING, ✔ SEARCH ENGINE OPTIMIZATION.  ✔YOUTUBE  ✔ADVERT ✔ MOVIE PROMOTION ✔CONCERT PROMOTION  ✔CROWD FUNDING  ✔ Trending Hastag  👉 Working with Top Cinematographer 👉 WEBSITE DESIGN. 👉 GRAPHIC DESIGN 👉 WEBSITE  👉  ARTIST PROMOTION 👉 VIDEOS ON NETFLIX.  👉 VIDEO ON TRACE GOSPEL  👉VIDEO ON TSTV & DSTV MUSIC CHANNEL  👉 RADIO INTERVIEW IN LAGOS, ABUJA, PH & IBADAN   👉 WRITTEN SONGS WITH 100% HIT  👉 SOCIAL MEDIA AUDIO PLATFORM PROMOTION WITH FOLLOWERS & PLAYS  👉YOTUBE SUBSCRIPTION WITH VIEW  👉 All Page Verified  Extra: * MEETING YOUR FAVORITE CELEBRITY HOME AND ABROAD  * INTERNATIONAL COLLABORATION DEAL  *INTERNATIONAL ENDORSEMENT DEAL  *INTERNATIONAL YOUR  *MOVING AROUND WITH HEAVY PRIVATE SECURITY  24/7 ...

Luxury Leather Massage Chair

Image
Luxury Executive leather Massage Chair Luxury Executive leather Massage Chair For your Luxury Executive leather Massage Chaircontact Evangelist Oladipupo Direct Line +234 8133385379 or call 0813 601 0277 It's very good for every one and recommended for every family. For more info Call: +234 8133385379 or call 0813 601 0277

Nigeria Politic: OGUN STATE GOVERNOR WAKA COME WITH JAGABAN

Image
Tori As We Dey Waka Come: Politic waka  OGUN STATE GOVERNOR WAKA COME WITH JAGABAN WEY DEY WAKA COME HAS PRESIDENT UNDER APC, DIS WAKA HAPPEN FOR FRANCE, GOVERNOR DAPO GO TOUCH LIGHT SOME MATTER WITH    TINUBU. Follow we waka ontop WhatsApp +2348133385379 ontop Instagram na @wakacometv on top YouTube subscribe to see we ogbonge videos Waka Come Tv. As we dey waka, no be lie.

Sport waka: Barcelona don waka come with Chelsea player

Image
Tori As We Dey Waka Come: #Sportwaka Conferment of di confirm waka na with Andrea's Chriatensen's wey wak a comort from Chelsea wey be shape club to Barcelona wey we dey call Baca. Follow we waka ontop WhatsApp +2348133385379 ontop Instagram na @wakacometv on top YouTube subscribe to see we ogbonge videos Waka Come Tv. As we dey waka, no be lie.

All Progressives Congress (APC) presidential primary election postponed.’

Image
Tori As We Dey Waka Come: Dis na di picture of APC Presidentail candidates APC Don waka Postpones Presidential Primary To June.  All Progressives Congress (APC) don waka come say dem postponement di special convention for the primary of the 2023 presidential election. According to him, the postponement followed the extension of the deadline for the submission of the list of candidates by political parties by the Independent National Electoral Commission. The ruling party waka come to adjust di primary election timetable and tell INEC make dem extend di deadline dis june.