Nigerian Super Eagles Kelechi Iheanacho goal make Mohammed Salah Pharaohs wan cry

Tori As We Dey Waka Come:
Na Nigerian player Kelechi Iheanacho goal give Super Eagles victory over Mohammed Salah Pharaohs


We Afcon winners Nigeria Super Eagles tackle seven time winners pharaohs of Egypt for Estadio Roumde Adjia stadium onTuesday 11th January 2022, for match wey many pipu say fit be di biggest game for dis Nations Cup for Cameroun so far.

We Eagles 19th appearance for Afcon tournament and dem dey try to win dia fourth trophy, dia opponents Pharaohs dey make dia 23rd appearance.

An also Egypt dey hope to get dia eight trophy.
Di two teams dey look forward to di FIFA world cup in Qatar as dem already progress to di next round of qualifiers

See How di match take waka come
Mohammed Salah wey be Egyptian captain take di first kick of di game as di refereee blow di whistle to signal di start of di match.

Egyptian player Mostafa Mohammed test we Nigerian goalkeeper, Okoye wit di first shot of di game.

Galatasaray striker shot from di right dey weak as Okoye comfortably catch am.

Who score di Goal for Nigeria! 

Na Leicester City striker Kelechi Iheanacho give Nigeria di lead.

Aribo head di ball to Iheanacho after Egypt block Simon cross, 'Seniorman' come fire wonderful half-volley into di roof of di net!
Na so we take score dem ooooo...
It's a goal!!!!!!!!!!!
Nigeria 1- Egypt 0








Follow we waka ontop whatapp +2348133385379 ontop Instagram na
@wakacometv on top YouTube subscribe to see we ogbonge videos Waka Come Tv.
As we dey waka, no be lie.

Comments

Popular posts from this blog

Kenya don dey hot, Tori As We Dey Waka Come

Nigerian chef: Hilda Baci don break Guinness World Record for ‘longest cooking time.

Cholera dey kill fast past Covid19 for Nigeria