Asuu Strike - Lecture dey para on top half salary for wey Gov pay dem.
Tori As We Dey WakaCome: Lecturers dey live life of struggle', Asuu tok afta goment pay 'half salary' Tori waka come out on Thursday say federal goment pay lecturers half salary for di month of October. Goment neva give reason for di payment wey dem make to di lecturers wey suspend dia almost nine month old strike for di same month. NaFriday 14 October dem suspend di strike and resume on Monday 17 October - "federal goment don reduce academic workers to daily paid workers," na so one lecturer tok. Dr Austen Sado, di National Investment Secretary of di Academic Staff Union of Universities (Asuu) for interview yan say dem dey disappointed in goment. Oga Sado wey be member of di National executive council of Asuu say part of wetin lecturers dey complain of na poor salary wey goment dey pay dem compared to how politicians dey collect plenty money. E say e no make sense say on top of di poor salary dem dey collect, goment still get m...