Abuja Biggest Entertainer, CEO of ND Motors, A.K.A ABig Nwamama, with him Album launch
Tori As We Dey WakaCome: We dey waka come with Abuja biggest entertainer, CEO of ND Motors, A.K.A ABig Nwamama, with him Album launch this Saturday. 20th of February 2021. Picture of Album Banner. Interview by DirectorKD: DirectorKD: Na who be Abig Nwamama? Nwamama: I be Power Bike engineer, I dey sell power bike and I dey do my music, I love music and my best sport na Bike race, I be cool and loving person, I love to entertain people with my bike and music. DirectorKD: we go like ask you about this your album, na wetin carry you waka to make this songs? Nwamama: I get plenty songs wey I don record, plus musical video wey I don shoot, so I say make I drop my album this Saturday wey go be 20th of February 2021, Inside this album we go see say I also want to help pray for Coronavirus make E waka go, I get song wey I also shoot the video with plenty power bike, Oyele and so many song wey I record as e dey hot. DirectorKD: tell us about your album, na wey dey come and how ...