21-year-old Abdul. B Drive car enter crowd for Berlin Pride event. 1 Dead, 16 Injured

Tori As We Dey Waka Come:

Police talk say 1 woman don die and 16 people don injure after car drive enter crowd for Berlin Pride event.

Dem also report say several people get stab for the attack. E happen around 10pm for Tiergarten park, near Brandenburg Gate — here na how e take happen.

Manhunt Dey Ongoing
Police say dem dey seriously search for one or more suspects for German capital. Dem don name one suspect as 21-year-old Abdul B.

Officers don release im picture. Dem say im get known link with Islamist groups, but dem never arrest anybody yet.

Police also show picture of white car wey dem suspect dem use for the attack. The car dey inside police cordon now.

"Na attack on our society"
German Chancellor Friedrich Merz talk say: "This na attack on our society." E promise say dem go investigate am with *"the highest seriousness."

Berlin Reporter Talk
"Berlin suppose wake up this morning with big hangover after sweet party. Instead, dem wake up to another sad news — another deadly attack hit the country."

Update from Fire Service
Berlin fire department spokesman, Dominik Pretz talk say out of the 16 people wey injure:

• 3 people get life-threatening injuries
• 8 people seriously injure
• 5 people get minor injuries

Police Don Name Suspect — Na 21-year-old Abdul B

Berlin police talk say dem dey search for 21-year-old suspect wey dem don name Abdul B.

According to police, "dem suspect am say na im injure several people with moving vehicle for Tiergarten area around 10pm."

Dem add say: "Dem believe say one or more people later run comot from the vehicle."

How the suspect look:
• Slim build
• Black hair
• Black hoodie and white trouser
• About 1.9m tall

Police warn say the man fit "armed and dangerous" and make nobody try approach am at all.

Police also talk say Abdul B get known connection with Islamist groups. Dem believe say im get link with the van wey drive enter crowd for other side of the park, wey kill 1 person and injure 16 others.

Shortly after — around 10pm last night — event organizers cancel the event. Hundreds of thousands of people dey there, and dem tell everybody to comot from the area.


As We Dey Waka, No Be Lie.
For Advert email us
E:mail wakacometv@gmail.com

Comments

Popular posts from this blog

Guinea Military coup: Soldiers don waka collect presidential power for Guinea.

Covid19: We need 3months before schools go fit open back again, House Of Representative.

Uganda Bobi Wine Under Home Arrest & Out Of Food.