Posts

France pipo dey fight for road: 50,000 pipo tested positive for coronavirus

Image
Tori As We Dey Waka Come: France on Saturday Talk say dem don record more than 50,000 people wey dey tested positive for coronavirus in the past 24 hours, as on top dis COVID-19. Di amount of pipo dey increase on top say dem dey give dem vaslin, dis matter make di Government  cancel all social party, clubs, office and all, say make pipo dey work from house and say Christmas and new year party no go happened, di government also yan say make small picking dem dey use nose mask and every body wey dey do gov work, on top wan video for social media for we YouTube channel wakacometv video we go see has di pipo wey don collect vaccine dey fight pipo wey never collect, say make dem go collect am has dis number dey increase and pipo dey die everyday.   Follow we waka ontop whatapp +2348133385379 ontop Instagram na @wakacometv on top YouTube subscribe to see we ogbonge videos Waka Come Tv. As we dey waka, no be lie.

12years old : Studen of Dowen College Death in details.

Image
Tori As We Dey Waka Come: Thousands of pipo don sign petition on top dis matter wey happen for Dowen Collage, Lagos state Nigeria, wey some group of cult students beat dis 12-year-old Sylvester Oromoni, before him die, him dey inside hospital with him family dey yan everything wey happen and how fear no fit let am talk, di state Gov don close dis school down and di ijow pipo plus plenty Nigerian all over di world dey sign petition say make dem give justice to dis matter. E never finish as him cousin brother  yan everything him sabi on top dis matter on Twitter... - Cousin brother to  Sylvester- tok wetin im know about wetin happen. Him yan am ontop Twitter say five boys bin block Sylvester, lock am for im hostel and give am one chemical to drink - nobody fit confirm wetin really happen because police neva tok anything because dem still dey investigate di matter. On top di waka officers don continue dia investigation, Sylvester father tok say im want D...

FESTAC TOWN: POLICE ENTER FIGHT WITH OKADA

Image
Tori As We Dey Waka Come: On top FESTAC TOWN. Di Tori wey cus gbege and wahala with okada and Police Task Force, dis matter cus plenty scarter scater inside featac town last week Saturday na on top so gbege we happen between,  okada and police. Olopa don dey waka since 2:30am today because of the wahala wey happeun on Saturday between okada riders and the Police Task Force.   Follow we waka ontop whatapp +2348133385379 ontop Instagram na @wakacometv on top YouTube subscribe to see we ogbonge videos Waka Come Tv. As we dey waka, no be lie.   

Guinea Military coup: Soldiers don waka collect presidential power for Guinea.

Image
Tori As We Dey Waka Come:   Militry don waka collect presidential power for Guinea. Dis gbas gbos matter, sup today wey be, Sunday 5th of September 2021, inside this hot sun as e dey hot,   Di oga wey carry dis waka na LT  Colonel Mamadi Doumbouya,  na him sojias dem waka go arrest di presido wey don dey for power since December 2010.  Guinea pipu dey jubilate with happiness has dem don collect presidential power for President Alpha Conde hand. Di soldiers yan say dis presido power wey dem waka come collect by fire by force, na ontop say di kontri pipu, dey die ontop dis poverty and corruption. Na who be dis Guinea presido wey dem dey call Alpha Condé, dis man na 83 years old, dem born am di year 1938 4th of March, him be politician wey don dey for Presido power since December 2010 till now wey gbege don happen dis month September 2021, dem don waka comort am for power.   For advert and sponsorship Call 08133385379 As We Dey Waka, No Be ...

Boko Haram Don Collect Kaure Village: Over 3,000 Pipo Don Dey Homeless Inside Niger State.

Image
Tori As We Dey Waka Come: Over 3,000 pipo don dey homeless as Boko Haram don collect dem village.  Di Niger State Governor, Abubaka Sani Bello don talk about we kontri Nigeria, on safety on top bokoharam matter, him talk inside dis video say, bokoharam don carry flag come outside for Kaure village inside Niger State. Him yan on top dis matter say na only 2hours this pipu fit take waka to Abuja from Niger State, him say make Federal Government help for security, as Niger State no far from Abuja. As di matter dey sup now, Abuja sef no dey safe again according to di tori wey him yan press pipo inside dis video. Click on dis link to fit see the video.👇🏼👇🏼👇🏼 Bokoharam take over kaure village wakacometv.blogspot.com send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or whatsapp +2348133385379. As We Dey Waka, No Be Lie. #wakacometv #toriaswedewakacome

58 Years Old Mother Raped to Death: In Calabar, Son Cries Out For Justice.

Image
Tori As We Dey Waka Come: One Nigerian man waka come on top social media for help on top him mama matter. Di man waka come outside to tell pipo make dem hellep am locate di pipo wey come kill him mama for house. According to di tori wey him talk on top twitter, him dey beg we kontri pipo, make we helep am find dis pipo wey beat him 58 years old mama to death. Madam Doris Andy Inyang, na business woman for Housing Estate inside Calabar wey dem kpai on Wednesday, April 14th 2021. Her son yan dis matter ontop dis twitter account @uti_xo, di man talk say dem rape him mama, beat him mama, strangle am, and cut her wrist. Dis pipo wey waka come attack him mama, di man talk say dem carry waka with some document and him own motto join. Ontop him twitter him talk all dis matter wey happen to him mama, him dey cry out for justice and to we pipo make dem helep am locate di motto wey di wicked pipo carry waka go. wakacometv.blogspot.com send your T...

Academic Staff Union Of Polytechnics(ASUP): waka with Strike on Today.

Image
Tori As We Dey Waka Come: Di Academic Staff Union of Polytechnics (ASUP) don waka come with update say dem dey Declare Immediate Strike Over New Salary Scheme for we kontri Nigeria. Di National President of ASUP, Anderson Ezeibe para say union’s strike must commence till dem meet all demands by the Federal Government. According to di union, di matter on Tuesday 6th of April 2021. ASUP leaders don confirm di strike matter  after him waka do meeting with Federal Government officials for Abuja. Asides dis strike matter, dem dey yan say make dem put money ontop di new salary scheme, the union dey yan say make dem pay dem di salaries and promotion allowances wey dem never pay lecturers.  National President of ASUP, Anderson Ezeibe wey dey insist say strike go go on, him say dem don dialogue with the Federal Government to resolve the issues wey dem raise.  wakacometv.blogspot.com send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gm...

Nigeria President Waka Come UK for Medical Treatment.

Image
Tori As We Dey Waka Come: Nigerian pipo wey dey obodo oyinbo land for UK, don waka protest against president Buhari medical trip. Him bin comot Nigeria on Tuesday 30th March, 2021 for two weeks medical checkup. Di protest waka come ontop di residents doctor's strike matter, wey dey sup for Nigeria. Dis waka wey start on 1 April, 2021-  days afta Buhari land London for im medical check-up. Dem dey yan ontop di protest say, government dey owe doctors dem salary and also refuse to pay oda allowances dem suppose get during di coronavirus pandemic. To express dia displeasure for di medical trip, Omokri lead a group of protesters to protest for di gate of di Nigeria Abuja House, dem parra well well, say make presido waka go back to Nigeria go do him medical checkup.  Dem dey vex say why di president go comot Nigeria wen Nigerian doctors dey on strike. wakacometv.blogspot.com send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or whatsapp ...

Gunmen Attack Prison for Owerri on Monday.

Image
Tori As We Dey Waka Come: Gunmen on Monday April 5th 2021, attack di Nigerian Correctional Services (NCS) for Owerri, Imo state capital for South East Nigeria. According to di tori, E happun around midnight and e never clear well well if prisoners escape from di prison. Na About 30 vehicles na im di gunmen burn down inside di police headquarters wey dey di same area. Di police headquarters dey opposite di Imo state government house. E no dey clear who carry out di attack at di moment. Dis no be di first time hoodlums dey attack prison officials and dia facility for Imo State. IGP for di statement wey im tok tok person CP Frank Mba, release say "di attempt by di attackers to gain access to where Police dey keep dia weapons for di Headquarters fail as officers wey dey on duty no allow dem. Di place where Police dey keep dia weapons dey intact and di police no record any death apart from di Police constable wey sustain mino...

Big Brother Naija (BBNaija) 2021 Application Form For Season 6

Image
Tori As We Dey Waka Come: Dis na How to Apply For BB9jia Una welcome to we igbonge reality Tv program for we kontri 9ja, dis 2021 Big Brother Naija winner go waka come with 90 million naira, e never finish ooo... For more tori and how to Waka on top dis matter, click on dis link 👇🏼👇🏼👇🏼👇🏼👇🏼 Big Brother Naija Season6 Year 2021 wakacometv.blogspot.com send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or whatsapp +2348133385379. As We Dey Waka, No Be Lie. #wakacometv #toriaswedewakacome #bb9ja #BB9jia #Bb9ja

Fatgbems Filling Station Sell Water to Customers in Disguise as Petrol Price Don Enter N212.

Image
Tori As We Dey Waka Come:  Di matter happen on Sunday 14th of March for Abeokuta, Southwest Nigeria within di same period wen fuel price hike bin happen for all filling stations across di kontri. Di matter don cast for social media, inside one video wey customer notice say na water dem sell give am, plenty pipo don come back to confirm di matter wey make dem car engine get fault. Dis video wey dey trend for social media show where some customers dey lament and accuse di filling station of cheating - di video also show where some car owners dey check dia vehicles to find how to comot di water from dia engine. Di management of Fatgbems filling station for di statement wey dem bring out tok say wetin make dia nozzle pump water instead of fuel na because of "water overflow into one of di station storage tanks." E talk inside statement say, "Fatgbems go like tok am again say di unfortunate incident dey against as we dey take do business as w...