clubs wey fit qualify for Europe Premier league
Tori As We Dey Waka Come: Sport Waka Di Champions League race bin look settled but Liverpool seven straight wins don drag dem back enta di race again. Manchester City and Arsenal already dey guaranteed to finish for di top four and Newcastle and Manchester United dey most likely to join dem dia. But, Liverpool now dey one point behind we no say dem don play one game more dan di Magpies and Red Devils. pipo no think say e dey possible but if dem slip, we gatz dey dia," manager Jurgen Klopp tok. "Dem go slip? I no know. We fit win both games? I no know." Di teams wey finish for di top seven go secure European football next season anchester City, wey fit win di Champions League dis season, and Arsenal, wit dia current totals of 85 and 81 points respectively, go finish as di top two. City go win di league if dem beat Chelsea on Sunday (16:00 BST). Newcastle and Manchester United occupy third and fourth place respectively, na only goal difference dey separate dem, on 66 poi...