Chris Brown Admit Say E Fight For London Club
Tori As We Dey Waka Come: Chris Brown Admit Say E Fight For London Club US singer Chris Brown don plead guilty to affray over fight wey happen for London nightclub for 2023 . Police say CCTV show how Brown, one of the biggest R&B stars for world, use glass bottle hit the man head several times. After dat, dem chase the man, push am ground and kick am. The 37-year-old singer suppose face trial for bigger charges wey include assault , attempt to cause serious injury , and carrying offensive weapon — na tequila bottle . But he deny all of dem. Now dem don drop those charges. Affray mean say you use or threaten violence make person fear for im life. If dem find you guilty, you fit go jail up to 3 years . Dem go sentence Brown for October . Brown vocal coach, Omololu Akinlolu wey be 40-year-old rapper from Florida, wey dem call Hoody Baby , too plead guilty to affray. Dem drop assault and attempted serious injury charges f...