Posts

TANKER FALL KON CATCH FIRE

Image
Tori As We Dey Waka Come: Today wey be Thursday 7th of January 2021, this afternoon na him di PETROLEUM  TANKER EXPLODE catch fire, as e somasult. The gbege make plenty pipo wey dey the area run go hide dem head, for safety. This particular waka happen for Apapa/Oshodi express way inside Lagos State. send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or whatsapp +2348133385379. As We Dey Waka, No Be Lie. #wakacometv #toriaswedewakacome #talkamafrica @talkamafrica

Who start Charlie Charlie challenge?

Image
Tori As We Dey Waka Come: Na waiting be Charlie Charlie challenge? Many pipo don yan say this challenge na evil spirit dey run the parrow, dem talk say na Demonic Angel be Charlie Charlie, say na evil spirit wey dey move pencil, say this na the way evil spirits dem dey use dey answer any question wey we human dey ask dem. Plenty pipo don run mad on top this waka, dem say this game dey answer question when dem call him name, Charlie three time. The game involve two pencils on top each oda, You go come put am on top of paper, wey dem write Yes or No.  The person way wan ask question go start to dey talk, after him don call charlie name three time, the pencil go move to answer the person question. send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or whatsapp +2348133385379. As We Dey Waka, No Be Lie. #wakacometv #toriaswedewakacome

Virginity vs Good character

Image
Talk-Am As E Dey Hot: My pipo, Between Virginity & Good Character, na which one be the major pride of a woman ?? Make we Remove Sentiment inside, talk am as e dey hot?!! send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or whatsapp +2348133385379. As We Dey Waka, No Be Lie. #wakacometv #toriaswedewakacome #talkamafrica

NIMC, don waka start strike across di kontri.

Image
Tori As We Dey Waka Come: Plenty pipo no go fit register dem phone number with NIMC, on top this new strike matter. Officials of the National Identity Management Communication (NIMC) don decide to go on nationwide strike across we konri, beginning from Today, Thursday, January 7, 2021. The NIMC staff wey protest today, complain say dem deny dem allowance and plenty jolificate money during this COVID-19 pandemic. Dem yan talk say, dem dey work under pressure with no allowance from the federal government send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or whatsapp +2348133385379. As We Dey Waka, No Be Lie. #wakacometv #toriaswedewakacome

Elevator crash kill one person, inside Ibadan.

Image
Tori As We Dey Waka Come: Elevator don crash kill one person, injure three pipo, this bad gbege happen for inside Cocoa House, for Ibadan.   send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or whatsapp +2348133385379. As We Dey Waka, No Be Lie. #wakacometv #toriaswedewakacome

Lagos State Deputy-govnor brother, don die.

Image
Tori As We Dey Waka Come: Dr Obafemi Haroun Hamzat, way be we Lagos State Deputy-governor brother, don die on top Covid-19 matter. Dr Hamzat die on Tuesday morning, according to di Lagos chapter of Nigeria medical association NMA.   send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or whatsapp +2348133385379. As We Dey Waka, No Be Lie. #wakacometv #toriaswedewakacome

Ritualists cut off 6 years old girl private part for Bauchi State, Nigeria.

Image
Tori As We Dey Waka Come: Ritualist for northern Nigeria cut The private part of 6 year old girl for Bauchi. Some bad pipo cut di private part of 6 year old girl inside Bauchi State, December 30th 2020, this na bad news, as e continue to weak many pipo for we kontri, Nigeria. Tori wey reach us today, be say, the girl currently dey under treatment, for hospital, inside Bauchi State.  World pipo make una dey try pay attention to una pikins dem ooo. send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or whatsapp +2348133385379. As We Dey Waka, No Be Lie. #wakacometv #toriaswedewakacome #talkamafrica send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or WhatsApp +2348133385379. As We Dey Waka, No Be Lie. #wakacometv #toriaswedewakacome

Tori been comot on Sunday say Tinubu catch covid-19.

Image
Tori As We Dey WakaCome:  Tori wey waka say Bola Ahmed Tinubu don catch Covid-19, the tori wey waka come, surprise every body for we country wey hear the matter, but no be the true yan be that.  Bola Ahmed Tinubu spokes person, Tunde Rahman, say di tori wey bin comot on Sunday say Bola Ahmed Tinubu catch covid-19, and say dem don carri am go France for treatment since December, na lie from di pit of hell.  According to di statement, true true di APC chieftain dey abroad. E come talk say "we don do covid-19 test on am, 15 times, wey im travel and im fit mix up with pipo.... "Asiwaju dey very ok and him dey fine, e no get covid-19" na so Mr Tunde tok. send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or whatsapp +2348133385379. As We Dey Waka, No Be Lie. #wakacometv #toriaswedewakacome

Schools go reopen in Rivers, 4th of January 2021

Image
Tori As We Dey WakaCome : School resumption 2021: Schools go reopen for Rivers and Bayelsa, dis January. Public and private schools for Rivers State go reopen for normal academic activities on Monday 4th January, 2021. Dis na according to statement from di State Ministry of Education wey di Permanent Secretary, Sir Chidi Adiele, sign. The tori different from di 18th January 2021 date wey Federal Government bin give for schools to reopen across di kontri, amidst dere plan and preparation against di second wave of di Covid-19 pandemic. send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or whatsapp +2348133385379. As We Dey Waka, No Be Lie. #wakacometv #toriaswedewakacome 

See why school fit no open this January 2021.

Image
Tori As We Dey WakaCome:  this na why school fit no resume this January 2021. According to the report from Africa CDC, them yan talk say, another new wave, wey dem call second wave of the virus, don dey waka inside we country Nigeria. Na the head of Africa's Centre for Disease Control, na im yan this one. Africa Centers for Disease Control and Prevention dey assess whether the vaccines wey dem produce go still dey effective for we body. Dem talk say, wetin we need to focus on na the measures wey go fit prevent transmission of COVID, and social distance. send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or whatsapp +2348133385379. As We Dey Waka, No Be Lie. #wakacometv #toriaswedewakacome 

Omah-Lay get Artist Twin Broda?

Image
Tori As We Dey WakaCome: controversial and trending 9ja artists, Omah-Lay don see him twin brother for we entertainment music industry, this him lookalike twin broda self dey sing well well like him and Kiss Daniels. Him name na Dimmybuoy , and him just drop new gbedu wey him call am " ARREST ME" . Even plenty reporters and celebrities dey mistake am for Omay Lay for live events. Dis matter na im dey we mouth, and other celebrities. Omahlay & Dimmybuoy, abeg na who be who for we music industry???. Send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or WhatsApp +2348133385379. As We Dey Waka, No Be Lie. #wakacometv #toriaswedewakacome