Posts

Nigeria Airport - Air line don waka end dier strike

Image
Tori As We Dey WakaCome: Di Air Transport Services Senior Staff Association of Nigeria (ATSSSAN) don end their strike against Bi-Courtney Aviation Services Limited (BASL) based on say dem sake 34 of their members dem without due process. Mr Frances Akinjole, Deputy General Secretary  of the union naim yarn say the union end their strike after when the Ministry of Labour & Employment, the Nigerian Civil Aviation Authority (NCAA), the Federal Airport Authority ( FAAN), the Nigerian  Airspace Management Agency (NAMA) and other airport security agencies bin do a meeting inside Lagos. Dis na di tori wey we carry waka come. As we dey waka, no be lie. Remember to follow us on top we social media page.  Facebook @wakacometv Instagram @wakacometv Follow us on top  twitter @wakacometv  You fit dey wachte us live on top we YouTube channel @wakavomeTv   If you get Tori for us, waka come we WhatsApp on 08133385379 or  send your Tori to we Email...

Nigerian Youth Service Corps

Image
Tori As We Dey WakaCome: Di National Youth Service Corps (NYSC) don come dey tell the brotherly and sisterly dem for inside we country say make dem no mind some kind informate for ontop social media wey dey ask coppers for akpalakpala to do their deployment, posting and the rest…say na some kind bad people wey wan fraud people.   NYSC Spokesperson, Eddy Megwa naim yarn dis one on Monday for inside one statement wey dem carry come out for inside Abuja.  Any informate wey you need, visit all the NYSC social media platforms . Dis na di tori wey we carry waka come. As we dey waka, no be lie. Remember to follow us on top we social media page.  Facebook @wakacometv Instagram @wakacometv Follow us on top  twitter @wakacometv  You fit dey wachte us live on top we YouTube channel @wakavomeTv   If you get Tori for us, waka come we WhatsApp on 08133385379 or  send your Tori to we Email: wakacometv@gmail.com  As w...

Indian olopa arrest 28 years old man

Image
Tori As We Dey WakaCome: India olopa don waka arrest one 28-year-old sake of say him molest, plus to do by force minimini- wanawana(rape) to fit enter di place of one small dog.  One 61-year-old wey be say naim dey ginger for animal rights naim fil the complain. for inside one video wey dem send to the man, for the the man dey do the do to the six-month-old dog.  As the matter take be, Last year for the same place, a dog wey im name na Nuri, naim one man too bin rape. Dis na di tori wey we carry waka come. As we dey waka, no be lie. Remember to follow us on top we social media page.  Facebook @wakacometv Instagram @wakacometv Follow us on top  twitter @wakacometv  You fit dey wachte us live on top we YouTube channel @wakavomeTv   If you get Tori for us, waka come we WhatsApp on 08133385379 or  send your Tori to we Email: wakacometv@gmail.com  As we dey waka, no be lie.

Fire inside Lagos

Image
Tori As We Dey WakaCome: Another fire don shele again inside Tejuosho textile market inside Lagos. Wetin cause the fire, never dey clear.. . . This one just dey happen as Fire bin burn one person and wunjure seven other people today as fire go catch for inside bank for Lagos. The bank na four- storey building wey dey for Plot 1114, Adeola Odeku Street, by Eletu Ogabi Close, Victoria Island. . . Meanwhile 1st November last year(2021) na Ikoyi building collapse wey kaput plenty people. Dis na di tori wey we carry waka come. As we dey waka, no be lie. Remember to follow us on top we social media page.  Facebook @wakacometv Instagram @wakacometv Follow us on top  twitter @wakacometv  You fit dey wachte us live on top we YouTube channel @wakavomeTv   If you get Tori for us, waka come we WhatsApp on 08133385379 or  send your Tori to we Email: wakacometv@gmail.com  As we dey waka, no be lie.

Dem Shoot American Rapper, Takeoff For Houston

Image
Tori As We Dey WakaCome: Tori waka come we ear say dem dom shoot American Rapper, Takeoff For Houston  Dem don shoot and kill American rapper Takeoff, from di chart-topping band Migos, for Houston, accord to wetin US media dey report. Olopa tell tori pipu for Variety magazine say dem kill di rapper for one bowling alley wia im bin dey play dice wit im uncle and bandmate, Quavo, on Tuesday morning. Di star, wey im real name na Kirshnik Khari Ball, be 28 years old. Migos na one of di most influential groups of dia generation, pioneering a style of rapping for choppy, staccato triplets wey pipo sabi as di "Migos flow". Di band, wey split earlier dis year, don gbab plenti international hits including Bad and Boujee, Versace and Walk It Talk It. Di shooting happun at about 02:30 local time (07:30 GMT) for one balcony outside di 810 Billiards and Bowling Alley. Olopa say 40 to 50 guests bin dey one private party wen one pesin open ...

Lagos Bus Driver on strike - Governor beg for meeting to see them on Wednesday.

Image
Tori As We Dey WakaCome: No be small gbege as pipu bin dey stranded for bus stop inside lagos, for early mor mor of today wey bi Monday 31st of October  2022, based on say commercial bus drivers under the umbrella of the Joint body Drivers’ Welfare Association of Nigeria (JDWAN) bin start seven-days strike because of anyhow extortion wey government officials dey do them. On dis strike waka, na so di transportation money waka come up...as pipu con dey pay plenty money to fit waka go dem destinations.  From Ijaiye to Oshodi wey be N400, before don  increase to N700 While transport money From Ijaiye to Agege waka come up to N400 instead of N200 naira. As E Dey Hot On top Dis Transportation waka  The Lagos State Government don call the ogas dem for Joint Drivers Welfare Association of Nigeria, JDWAN, to do meeting on Wednesday, 2nd of November so that dem go fit find solutions to everything wey dem dey ginger for. dis na di list of pip...

Nigeria Navy waka with NAPTIP Rescue 50 girls from Ashawo Trafficker pipu hand.

Image
Tori As We Dey WakaCome: Di Nigeria Navy on top water don waka rescue 50 women from ashawo waka, on top dis matter as e dey hot, dem don arrest 3 pipu wey dem dey suspect say na ashawo International waka, dat wan wey oyinbo dey call sex traffickers inside Port Harcourt. Lt.-Cdr. Richard Iginla, Base Information Officer, Nigerian Navy Ship (NNS) Pathfinder, do did waka to rescued dis victims for PH city on Sunday. Iginla yan say did waka join body with Nigeria Agency for the Prohibition of Trafficking in Persons (NAPTIP) and the Nigeria Security and Civil Defence Corps (NSCDC). According to Iginla, inside Dis 50 Ashawo teenage girls follow dey inside wey dem  rescued, early mormor on Saturday. Dem yan say na with di help of NAPTIP, wey give dem dis information, because dem self don dey do investigation on top di matter, with small pikin of  14 years of age. Na 50 young girls dis traffickers forced into ashawo work, that wan w...

Nigeria U-17 women Goal Keeper Omilana saved di ball for penalty shootout

Image
Tori As We Dey WakaCome:  On top we sport waka with Nigeria Under 17 women. We Nigeria U-17 women Goal Keeper Omilana saved di ball wey make we kuntry win Germany for bronze medal  We Nigeria’s U-17 Women’s team, Flamingoes give Germany wotowoto on top penalty, we dem use collect bronze medal inside dis FIFA U-17 Women’s World Cup sport waka, dem give 3-2 dem give Germany ontop penalty we dem play. We Nigerian Flamingoes bin dey 3 goals before Germany waka draw with dem, na dis draw we dem two enter make dem play penalty. As we dey waka, no be lie. send your Tori to we Email: wakacometv@gmail.com Follow us on top Instagram @wakacometv Follow usom top twitter @wakacometv Follow us on top Facebook @wakacometv

Danfo Bus for lagos Go waka Protest on Monday, dem go Boycott work - Dis na why

Image
Tori As We Dey WakaCome: All di commercial driver for lagos state don yan  say, dem go waka for seven days protest. According to dem, Na sake of allegations of plenty extortion by di management of parks and garages wey dey inside di south west state. Dem waka come with di Joint Drivers' Welfare Association of Nigeria (JDWAN) tok am for one press statement dem release ova di weekend. Wan person wey be JDWAN too say dem dey saddened say despite our dedication to our work, we dey subjected to indiscriminate extortion, violent harassment by di management. Dem National Leader of di association, Comrade Akintade Abiodun say di multiple levies on di joint drivers by di garage boys and law enforcement agents don cause increase in di prices of food items for Lagos compared wit oda states, as garage boys wey mount road blocks on Lagos road dey put plenty money on consignments wey dey enta di state. WATING DEM DEY ASK FOR  Bus drivers for Lagos say dem ...

President Buhari yan on top di Terror wahala inside Abuja

Image
Tori As We Dey WakaCome: Nigerian President Buhari don react on top di terror alart inside Abuja, BuBu yan say make una no fear say di US and UK advice to dia pipo no call for panic. Nigeria President Muhammadu Buhari say di terror alert by di foreign kontris no mean say attack go happun. Nigeria leader reaction dey come as some kontri bin first issue terror alert say threat of terror attack dey for Abuja. Bubu yan for statement wey im tok-tok pesin, Garba Shehu release on Friday say im don charge security operatives to dey alert since afta di attack on Kuje prison. “No be only Nigeria dey di list of terror threats by foreign goment travel advice to to dia citizens. UK and US travel advisories also tok of  terror attacks wey fit happun for many Western European nations. “However, e no mean say attack go happun for Abuja,” di statement tok. As we dey waka, no be lie. send your Tori to we Email: wakacometv@gmail...

Flood water kill pipu for Yenagoa, di Bayelsa State capital inside Nigeria

Image
Tori As We Dey WakaCome: How di death of 16 year old Temedi  Yerimene wey drown becos of flooding for Igbogene community for Yenagoa, di Bayelsa State capital, Southern Nigeria na one of di major losses pipo dey count for di flood palava Nigeria dey suffer so. Di boy na from Amabulu in Ojobo community of Ekeremor LGA of Bayelsa but di family dey live for Igbogene. Tori be say di flood push di young boy into di deep canal for di area wen im and im friends go swim for di flood water close to di Bayelsa Ecumenical Centre. Mama of di boy, Yerimene Waka Come yan say di incident happen on Monday 10 October 2022 around 11am in di morning wen im go swimming. "I come back from market and dem tell me say im go swim. I bin think say im go swim for di water wey dey flood for our compound until one of im friends tell me say na di flood drag am into di canal." Efforts by di community search party wey go search for di boy no dey...