Posts

South-East don Ban Cows, make dem no dey waka again for road.

Image
Tori As We Dey Waka Come: South east Ban Cows by foot: No more Open Grazing, Umahi explain why dem ban movement of cows by foot. South-east governor don ban open grazing, di Chairman Southeast Governors' Forum, David Umahi don confirm. Governor Umahi of Ebonyi say di South-east zone ban open grazing of cattle inside dia areas Na during one APC stakeholder meeting for Christian Ecumenical Centre Abakaliki, di Ebonyi State Governor announce dis mata. Di South-east Governors' Forum also ban di movement of cows by foot into di zone and beg leaders to show loyalty to Nigeria alias patriotism for dia conduct to guarantee di unity of di kontri. Governor David Umahi say: "We dey live in a dangerous time, without patriotism to our nation Nigeria, e dey very difficult to get a peaceful time" Make leaders and stakeholders of di zone to speak up and avoid playing politics with di Security of di zone and nation. "Governors of South-east don dey cal...

Pavilion Hotel Ayepe: Hotel wey dey look pipu naked inside room.

Image
Tori As We Dey Waka Come: Pavilion Hotel Ayepe: Hotel wey dey look pipu naked inside room. Nigerians don begin react to one video wey show face for internet wey claim say one hotel for Ogun state hide cameras for inside di rooms wey guest dey lodge. Dem also warn pipo to dey careful of di kain hotel dem go dey lodge. Di pipo wey dey dis video, para for di hotel management, why dem go install camera inside di rooms. Di men wey dey para for di video say dem discover say dem hide di camera inside Air Conditioner for dia rooms. Dem talk say di camera don record all dia family naked body. Nigeria Hotel Association say dem still dey torchlight di mata and dey try find out di particular hotel wey di thing take happun. Oga Akpovwovwo say hotels "fit install cameras for di corridor, staircase, back of di hotel but for inside rooms e dey wrong." installation of cameras for inside guest rooms dey very wrong, na invasion of guest privacy and e dey devili...

Ogun state security: Sunday Igboho help to chase out, killer herdsmen'.

Image
Tori As We Dey Waka Come: Sunday Adeyemo aka Sunday Igboho address youths for Ogun state on Monday as e enta bush to go draw ear for herdsmen wey dey di state. Plenti pipo gather for Ogun state on Monday to meet wit di Human right activist, Sunday Igboho wey give herdsmen ultimatum to comot from Yoruba lands. In di past week, im bin give herdsmen for Oyo State, wey be im home state seven days deadline to leave di state on top accuse of Kidnap, rape and killings of farmers and pipo for di state. On Monday Sunday Igboho carry di campaign to pursue di herdsmen from yoruba land enta Ogun State. Im tok say Ogun state goment no want as herdsmen dey allegedly rape women for di state, Kidnap pipo and kill some of im citizens. "Ogun state govnor, kings for di state and all Yoruba pipo say dem no want make [herders] dey take over our farm, dey Kidnap us for our land disturb us, dis na why we enta Ogun State to adress di mata." Sunday Igboho charge di youths we...

Covid-19 Vaccine: Christian Association Of Nigeria, (CAN) tell President make him take am first.

Image
 Tori As We Dey Waka Come: Christian Association of Nigeria (CAN) talk say Dis COVID-19 Vaccination wey dem want Nigerians to take, go start from President Muhammadu Buhari and him government officials. CAN talk say make our leaders wey dey govern we kontri take am first, before we di pipu go follow waka on top di vaccination, na leadership by example, make pipu see say di vaccination good well well for body to fit take. Na on Wednesday dem talk dis matter on top Covid19 Vaccination, as President don sign for law on Wednesday, say na for we kontri and for pipu Health protection. Chairman, Christian Association of Nigeria (CAN) Lagos State chapter, Bishop Stephen Adegbite (left); Secretary to the Government of the Federation/ Chairman Presidential Task Force on COVID-19, Boss Mustapha and Executive Director, Nigerian Interfaith Action Association (NIFAA), Bishop Sunday Onuoha during a sensitisation meeting on COVID-19 vaccine introduction for Christian leaders and scholars inside Ab...

Gunmen free orphans, for Rachael Orphanage Home.

Image
 Tori As We Dey Waka Come: Abuja Orphanage Kidnap: Dem don free orphans for Rachael Orphanage Home for Abaji Gunmen dem free orphans for Rachael Orphanage Home for Abaji, a week after Abuja Orphanage Kidnap. Di orphans wey dem kidnap a week ago from Rachael Orphanage Home for Abaji, Abuja don get dia freedom. Di seven pikin dem wey be Elizabeth Andrew, Dayo Udeh, Jacob Ukpas, Melody Ijeh, Bernard Itim, Isaac Mathew and Laruba Emmanuel gain dia free on di 31th of January. Security Agency yan say, di pipu wey dem dey receive treatment for general hospital for Abaji sake of di way di gunmen torture dem, according to authorities. Tori wey waka come be say, on Saturday, 24th of January, around 1:00 am, plenti gunmen with heavy weapon bin attack di Rachael orphanage wey dey opposite UBE Junior Secondary School for Naharati, Abaji Area Council, Abuja. Dem bin enta through di main gate and force di gate open. Dem come rush straight to di room of di orphans com pick di ones wey dia hand rea...

PSC: Dem Don Promote plenty police officers Dem.

Image
Tori As We Dey Waka Come: IGP Mohammed Adamu We Nigerian Police Service Commission, (PSC). Don Promote plenty police officers dem. Na Nine Commissioners of Police wey go enter for Di rank of Assistant Inspectors General of Police and another nine, wey dem promote from di rank of Deputy Commissioner to Commissioners of Police. Di Commission sef approve Di promotion of three Chief Superintendents to Assistant Commissioners of Police, 1,577 Deputy Superintendents to Superintendents of Police and 2,293 Assistant Superintendents to Deputy Superintendents of Police. Dem also approve the promotion/confirmation of seven thousand, two hundred and eight three unconfirmed Assistant Superintendents (ASP11) to Assistant Superintendents of Police (ASP1), nine thousand and seventy two Inspectors to Assistant Superintendents of Police (ASP11) and one hundred and ten Inspectors promoted to Senior Inspectors. Di new Assistant Inspectors General na; Aminu Saleh Pai, former Commissioner of Police ...

Nigeria President, sack im service chiefs, appoint new service chief on Tuesday.

Image
Tori As We Dey Waka Come: Nigeria President Muhammadu Buhari don sack im service chiefs wey him appoint for office since july 2015, on Tuesday na him President Buhari sack dem come replace dem with this new pipu dem, this na di name of Nigeria new service chief, Major-General L.E.O Irabor, go replace General Abayomi Olonisakin, Rear Admiral A.Z Gambo, go replace Vice Admiral Ibok-Ete Ekwe, Air-Vice Marshal I.O Amao, go replace Air Marshal Sadique Abubakar, Major-General I. Attahiru, go replace Lieutenant General Tukur Yusuf Buratai. Dis Na Di Picture of Di new service chiefs wey  President Muhammadu Buhari appoint on Tuesday. Dis Na Picture Of President Buhari and the old Service Chiefs wey him sack on Tuesday, for inside one meeting for Presidential Villa Abuja. Na on di 13th July, 2015 (four years and six months ago) na im Buhari bin appoint all the service chiefs. Sake of tension and security concerns wey dey the west African kontri for som...

Militan enter Imo State, wey make Curfew start on monday January 25, 2021.

Image
Tori As We Dey Waka Come: Di Governor Imo State on Monday, January 25, 2021, yan about waiting dey sup wey make am declare curfew. Governor Hope Odidika Uzodinma, don yan give doesesidents of him State, say, time go dey dey wey pipu no go fit waka come outside at all, him do dis waka on top wating happen inside some local government areas fo Imo State, na only 9 local government dis curfew dey waka with, di name of dis 9 local government na, Orlu, Orsu, Oru East, Oru West, Ideato North, Ideato South, Njaba, Isu, Nwangele and Nkwerre local government areas of Orlu zone. Di Governor take dis action after wetin happen for Imo state with some soldiers and militants. Some pipu talk say di matter wey happen between soldiers and militants pipu, wey dey worry ontop di State, according to di pipu wey see as di matter happen, say di militant don kill and destroy things. Governor dey beg di security pipu, make dem catch dis bad pipu wey dey do dis killing, to fit put dem for jail, dis...

OPC warn President Buhari and Fulani herdsmen

Image
Tori as we dey waka come: OPC warn President Buhari, say dem support Sunday Igboho. Dis Sunday na him Di Oodua pipu warn president Buhari say, dem no dey joke ontop dis matter at all, as him don make am clear say him dey support dis herdsmen wey dey enter villages dey kill pipu, dem say dis na warning, make dis herdsmen waka comot from yoruba kingdom. Mr Wasiu Afolabi, Deputy President to the late OPC Founder, Dr Fredrick Fasehun, yan say, no Southerner go waka enter North go dey kill pipu, but why dis northern pipu dey enter pipu zone dey kill kill, and Nigeria President no dey yan ontop dis bad waka. OPC talk inside Sunday Igboho matter, say na good thing Sunday waka do, to protect yoruba kingdom, say dem support Sunday, and make dem free Sunday from any arrest. Odua pipu don halla give President Buhari say make him stop to dey take side on top dis killing wey herdsmen dey kill kill innocent pipu for insde dia land, Oodua don come outside with Amotekun to fit stop dis bad pipu wey de...

Sunday Igboho: Fulani Herdsmen Dey Plan War

Image
Tori as we dey waka come: Yoruba's don Fem Governor of Oyo state, say him no dey support the safety and security of Yoruba land but him dey play on top dis matter, for him own political ait. Sunday Igboho, don dey rain for news, as him help to secure and stop bad pipo wey dey kill innocent pipo inside Yoruba land. Him bin give fulani pipo wey dey kill pipo inside bush, seven-days make dem carry dia self comot for Yoruba land, as dem no sabi good thing to do, dan to dey kill and kidnap pipo inside forests. Oyo State Governor, don yan on top dis matter say, no be Fulani pipo dey kill pipo. Mr. Igboho Sunday Na October 10th 1972, dem born am, inside Igboho town, for Oke-Ogun, Oyo State. Na youth activist for Yoruba land him bi, but some pipo dey yan about am say Na politician dem sabi say him bi.   The whole of YORUBA Kingdom dey vex with President Buhari and the IGP wey say make dem arrest Sunday Igboho, dem talk say Sunday Igboho dey do better waka to help secure Yoruba land f...

Gunmen attack Dutsin Gari Village and others

Image
Tori As We Dey Waka Come: Di villages gunmen attack na Dutsin Gari, Asha-lafiya, Rayau, Munkuru, Mahunta and Talli. Maigari yan say di residents of di affected villages want make government help dem. Matawalle yan to the community pipo say, make dem no worry say him and him pipo go helep dem. Him say him dey worry ontop di matter wey happen, say him no happy at all, and him dey feel serious pain ontop the matter. “I assure you that I will do everything within my powers to make sure that you go back to your respective villages." Him yan Him talk as him go make sure say dem dey okay and every body dey safe for dia villages. www.wakacometv.blogspot.com send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or whatsapp +2348133385379. As We Dey Waka, No Be Lie. #wakacometv #toriaswedewakacome