Posts

Daniel Wilson Timeless Album: dis na new gbedu, wey just waka come outside, as e dey hot.

Image
Tori As We Dey Waka Come: We dey jolificate with we Nigerian Music Icon, for we industry, na Legendary Musician im be, we dey talk about our one and only Daniel Wilson, wey be king of RnB music, im don come out with dis Album wey him call am, TIMELESS. Dis na cool jam for old and young, na im oyinbo man dey call ever green music, di song dey sweet for body. Dis Album na 18 tracks wey dey totori person, as e dey hot. Track: 1. language barrier (feat. Abobi Eddiroll) Track: 2. Abortion (feat.BZB) Track: 3.  Good Old Days Track: 4.  The Virus Is Real Track: 5.  Mr Ragamuffin Track: 6.  Oyato' (feat. Gran-P & Obitunez) Track: 7. My Body Is Getting Weak Track: 8.  Heartbreaker Track: 9. 999 Track: 10. Children Of Africa Track: 11. One Naija Track: 12. The government You Deserve Track: 13. Jonathan Been Try Track: 14. Do Something Track: 15. The Youth Are Taking Over Track: 16. Personal Person (Feat. BZB) Track: 17. Foll...

Covid19: See Who Go Collect Di 3.92 Million Doses Qf Di AstraZeneca Vaccine Wey Just Enter Nigeria.

Image
Tori As We Dey Waka Come: Picture of di 3.92 million doses of di AstraZeneca vaccine wey just enter Nigeria. AstraZeneca vaccines don enter we kontri Nigeria, dis go make Nigeria di next West African kontri to collect di COVAX Facility after Cote d'Ivoire and Ghana. Di arrival of di vaccine go enable dem begin vaccinate Nigerians in priority groups, starting with di frontline health workers, na so NPHCDA talk. At all levels, di cold chain facilities wey dem go store di vaccine don dey ready. Mr Osagie Ehanire wey be di Minister of Health for we kontri Nigeria, don receive di 3.92 million doses of di AstraZeneca vaccine as e arrive di kontri capital, Abuja yesterday. Dem don dey train all di health workers wey go administer di vaccination, na so di National Primary Health Care Development Agency, yan inside statement wey di World Health Organization and UNICEF join body do. wakacometv.blogspot.com send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmai...

Covid19: Ghana President Nana Akufo-Addo and Him Vice President, Bawumia Go Receive Di First Dose of Di Covid-19 Vaccine

Image
Tori As We Dey Waka Come:  Ghana President Nana Akufo-Addo and him vice president, Bawumia go receive di first dose of di Covid-19 vaccine. For im yan, President Akufo-Addo him talk say,  dem go deploy di vaccines go 43 districts wey be di epicentres of di pandemic for Ghana, im yan say through di National Vaccine Deployment Plan, dem don segment Ghana population into four groups, and dis go determine which section of di population go collect vaccination at a particular time. 600,000 doses of di vaccine arrive Ghana on February 24, 2021, Ghana na di first African kontri for di world to receive di AstraZeneca vaccines from di COVAX facility. Ghana number one and number two citizens go take di vaccine together with dia spouse live on TV so as to encourage Ghanaians say di vaccine dey safe to take. wakacometv.blogspot.com send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or whatsapp +23481333853...

Sunday Igboho: DSS Waka Fail as Dem Try to Carry am.

Image
Tori As We Dey Waka Come: Security Agency, wey dem dey call DSS and  soldier try to arrest Yoruba activist Sunday Adeyemo Igboho, for road along Lagos-Ibadan expressway on Friday, february 26th 2021, him followers no allow dem to carry am as dem ready to protect dia leader. Di matter bi say Sunday Igboho bin go meet Yoruba socio-political group, Afenifere chief, Ayo Adebanjo wen di matter happen, as im dey go for road na him DSS and some Army block am for road. Sunday Igboho Media person yan say di matter happen around 2pm wen dem bin dey on dia way out of Afenifere house, two heavily armed military operatives stop dem come ask if Sunday dey inside di motor, na so wahala start, Sunday boys no allow dem to carry am. Inside did video una go see as Sunday follow dey parra, dem no allow DSS to carry any action. wakacometv.blogspot.com send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or whatsapp +2348133385379. As We Dey Waka, No Be Lie. #wakacometv #toriaswedewaka...

Zamfara kidnapping: Gunmen Abduct 300 plus Jangebe Government Secondary School Girls.

Image
Tori As We Dey Waka Come:  Di Zamfara state police command don confirm di abduction of 300 plus students wey gunmen kidnap from dia boarding secondary school early today for di town of Jangebe, for Zamfara state. Father of one of di kidnapped Jangebe students say: E dey pain me say I no follow go visit my pikin di last time. Father of one of di kidnapped students for Government Girls Secondary School Jangebe don share im pain and how E feel wen news of him daughters kidnap reach im ear. Mohammed Rilwanu talk say two of im daughters dey among di 300 plus students wey gunmen kidnap from Government Girls Secondary School Jangebe on Friday the 26th. E talk say since di news of di daughters kidnap reach am, for hours now wetin dey im mind na how e no follow go visit dem last month during di school visiting day. Him bin receive phone call about wetin happen for di school around 1:45am till 3am and by di time im reach there some parents don dey there but by...

Promo! Promo!! Promo!!!

Image
Awoof Awoof Awoof!!!! E no de purge belle... Dis na ogbonge awoof promo for everybody way dey into music, waka come Tv don waka come with better awoof wey go hellep you wey be musician to get ogbonge musical video with 4K camera and better jolification waka on top dis matter now, with just 600,000 six hundred thousand naira, you go shoot standard MTV/SoundCity/TraceTv, musical video quality plus 1month promo on top one of dis Tv station, e never finish o!!! Plenty ogbonge media promo follow waka ontop dis matter. Di number to call na 08133385379                             .............................English..........................   Shoot a music video with 600K six hundred thousand naira, and get 1 month free promotion on any of this musical Tv station like MTV/SoundCity/TraceTv and more. guess the amazing thing, you are shooting on 4k, not 2k, 2.5k b...

Orlu crisis: Nigerian Army send helicopter go Orlu.

Image
Tori As We Dey WakaCome:  Military dey do air strike for Orlu as we dey see inside dis video Nigeria Military helicopter go Orlu town, for Imo State, southeast of Nigeria. Three weeks ago, jaguda pipo do shooting for di area kill pipo and burn some houses. E dey on top all social media for Nigeria on top dis matter wey dey hot for Orlu, some local tori pipo dey report say Nigeria Military dey conduct air strikes for Orlu as dem dey try catch members of Eastern Security Network (ESN). Different video of this matter dey sup on top twitter, Instagram and Facebook.   Helicopter fly pass dem as e fly out of di view of di video you fit hear gun shot. One man voice dey shout, "ha! Jesus Christ o! wia dis one dey? Ha! Why dis pipo dey waka upandan abeg? Why dis pipo dey… Jesus see gun. Ha!... make everybody enta... See di video: wakacometv.blogspot.com send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or whatsapp +2348133385379. As We Dey Waka, No Be Lie. #wa...

Breaking News: Mysterious Death of National Open University Nigeria (NOUN) Student.

Image
Tori As We Dey WakaCome:  Mr Adisa Kehinde Ashimolowo talk say im be Fatimah Papa, Mr Adisa Kehinde  Ashimolowo dey stay for Ibadan, with Fatimah wey be him first daughter. Im say dem call am on top phone say im daughter fatimah waka go write exam on di 17th of February in the morning and later dem call am di next day on di 18th say dem see her dead body for road Gbagada under bridge, Lagos. Him talk say di person wey see him daughter body, wey be di eye witness yan say dem no see im daughter phone with am. Mr Adisa Kehinde Ashimolowo confirmed say dem bury her for Lagos inside Atan Cemetery that same day because im na Muslim man.  Di CONS National president talk to Mr Adisa Kehinde Ashimolowo say all di students grievance for di sad news of fatimah's wey die and dem go protest. Mr Adisa Kehinde Ashimolowo talk say di students fit waka come to visit their house for *Alfa Ojuotono House, by Kulodi Market, Amuloko area, Iwo Road Ibadan, O...

Wizkid, Omah Lay and Plenty Celeb waka come with Headies 14th Edition Award dis February 2021.

Image
Tori As We Dey WakaCome:  Dis na di pipo wey waka go house with Headies for di 14th edition Headies Award 2021, wey happen did February, di award waka come with ogboge celebrity like Wizkid, wey dem dey call star boy Machanla, E waka with Award as Artiste of The Year, Omah Lay win Next Rated, Mayoukun, Fireboy and plenty odas waka with Awards too.  Fireboy win four awards for di 14th edition of di Headies, wey be music award show for we kontri Nigeria. Him win Best R&B Single, Best R&B Album, Best Pop Award and Best Headies Revelation to make am di artiste wey pack di most awards waka go house. Starboy Wizkid win Artiste of di year and Viewers Choice Award. Di award show bin hold online to keep with di Covid 19 restriction for Lagos, but plenti pipo still gada around di streaming platforms to see di show as e dey hot. We very own King Sunny Ade collect award as him join di Headies Hall of Fame. Nini...

Kaduna state: Armed bandits don burn down the building of di Holy Family Catholic Church.

Image
Tori As We Dey WakaCome:  Armed bandits don burn down the building of di Holy Family Catholic Church, and two homes, inside Kikwari village, Kajuru local government area for Kaduna state. Samuel Aruwan, Commissioner, Ministry of Internal Security and Home Affairs, Kaduna State, talk on Sunday, say pipo run com or for di area when di gbege start, as dem receive information say bandits dey outside di village. Di armed bandits burn di church and two houses. Di Governor El-Rufai feel very bad, him talk say him go use him office to give protection and hellep to provide for di pipo and continue to work hard to fight against banditry and other crimes. Him tell worshippers to remain strong in their faith and devotion, and to see dis as an act perpetrated by enemies of peace, humanity and diversity wey no go succeed but will be defeated by the grace of God. Di Governor don direct di Kaduna State Emergency Management Agency to urgently assess the damage done...

BELLO AMBASSADORS NETWORK, (BAN)

Image
BELLO AMBASSADORS NETWORK, (BAN) www.ban2023.org E sweet us for belle as we don waka come with ogbonge network for the Nigerian youths for we kontri Nigeria, from six (6) geopolitical zones and thirty-six (36) states for we federation. Dis na non-governmental Organisation with common agenda to fit copi di leadership and charitable character of Governor Yahaya Bello of Kogi State. Dem dey support to helep we pipu wey need urgent help to support dem as Governor, and Yahaya Bello dey promote quality leadership. As the youngest Governor for Nigeria, Yahaya Bello don do better waka and him build cabinet of young Nigerians sote e no even look tribe, gender and religion. The ogbonge waka of Governor Yahaya Bello for areas of Education, Healthcare, Agriculture, Security and Infrastructure reach something wey we suppose dey give national recognition for. We don see courage, intelligence and love of every Nigerian for inside Governor Yahaya Bello with the wey him be dey c...