Posts

Ritualists cut off 6 years old girl private part for Bauchi State, Nigeria.

Image
Tori As We Dey Waka Come: Ritualist for northern Nigeria cut The private part of 6 year old girl for Bauchi. Some bad pipo cut di private part of 6 year old girl inside Bauchi State, December 30th 2020, this na bad news, as e continue to weak many pipo for we kontri, Nigeria. Tori wey reach us today, be say, the girl currently dey under treatment, for hospital, inside Bauchi State.  World pipo make una dey try pay attention to una pikins dem ooo. send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or whatsapp +2348133385379. As We Dey Waka, No Be Lie. #wakacometv #toriaswedewakacome #talkamafrica send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or WhatsApp +2348133385379. As We Dey Waka, No Be Lie. #wakacometv #toriaswedewakacome

Tori been comot on Sunday say Tinubu catch covid-19.

Image
Tori As We Dey WakaCome:  Tori wey waka say Bola Ahmed Tinubu don catch Covid-19, the tori wey waka come, surprise every body for we country wey hear the matter, but no be the true yan be that.  Bola Ahmed Tinubu spokes person, Tunde Rahman, say di tori wey bin comot on Sunday say Bola Ahmed Tinubu catch covid-19, and say dem don carri am go France for treatment since December, na lie from di pit of hell.  According to di statement, true true di APC chieftain dey abroad. E come talk say "we don do covid-19 test on am, 15 times, wey im travel and im fit mix up with pipo.... "Asiwaju dey very ok and him dey fine, e no get covid-19" na so Mr Tunde tok. send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or whatsapp +2348133385379. As We Dey Waka, No Be Lie. #wakacometv #toriaswedewakacome

Schools go reopen in Rivers, 4th of January 2021

Image
Tori As We Dey WakaCome : School resumption 2021: Schools go reopen for Rivers and Bayelsa, dis January. Public and private schools for Rivers State go reopen for normal academic activities on Monday 4th January, 2021. Dis na according to statement from di State Ministry of Education wey di Permanent Secretary, Sir Chidi Adiele, sign. The tori different from di 18th January 2021 date wey Federal Government bin give for schools to reopen across di kontri, amidst dere plan and preparation against di second wave of di Covid-19 pandemic. send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or whatsapp +2348133385379. As We Dey Waka, No Be Lie. #wakacometv #toriaswedewakacome 

See why school fit no open this January 2021.

Image
Tori As We Dey WakaCome:  this na why school fit no resume this January 2021. According to the report from Africa CDC, them yan talk say, another new wave, wey dem call second wave of the virus, don dey waka inside we country Nigeria. Na the head of Africa's Centre for Disease Control, na im yan this one. Africa Centers for Disease Control and Prevention dey assess whether the vaccines wey dem produce go still dey effective for we body. Dem talk say, wetin we need to focus on na the measures wey go fit prevent transmission of COVID, and social distance. send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or whatsapp +2348133385379. As We Dey Waka, No Be Lie. #wakacometv #toriaswedewakacome 

Omah-Lay get Artist Twin Broda?

Image
Tori As We Dey WakaCome: controversial and trending 9ja artists, Omah-Lay don see him twin brother for we entertainment music industry, this him lookalike twin broda self dey sing well well like him and Kiss Daniels. Him name na Dimmybuoy , and him just drop new gbedu wey him call am " ARREST ME" . Even plenty reporters and celebrities dey mistake am for Omay Lay for live events. Dis matter na im dey we mouth, and other celebrities. Omahlay & Dimmybuoy, abeg na who be who for we music industry???. Send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or WhatsApp +2348133385379. As We Dey Waka, No Be Lie. #wakacometv #toriaswedewakacome   

Nigerian rapper, way dey blow pipo mind this 2021.

Image
Tori As We Dey WakaCome: Rap jam for this 2021, from Jizzydust. Una remember our very own Nigerian rapper wey sing hit jam, LIFE NA JEJE, him full name na Onogbo Roland Omonigho a.k.a Jizzydust, him na Hip-Hop artist wey dey rap like Kanyewest & Jayz, E don drop new rap gbedu, for 2021 him call this jam, NO PEN FLOW. Send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or whatsapp +2348133385379. As We Dey Waka, No Be Lie. #wakacometv #toriaswedewakacome 

shybaby! Nigerian International UK Base artiste, with hit gbedu, dis 2021.

Image
Tori As We Dey WakaCome: Dis artiste na him dey on top music waka, she go blow una mind dis 2021, na the artiste way pipo dem dey wait for, inside obodoyinbo for UK. Shybaby wey don work with plenty big Nigerian artiste dem. Dem dey enjoy her song inside obodoyinbo, has she be UK base International female artiste, wey dey drop plenty gbedu, her full name na, Adesayo Lawal-Solarin, she don waka drop hot gbedu wey dey jam 2021 everywhere, the song title na Gbesunmobi, e dey for all music platform, na her song dey hot dis 2021.   Send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or whatsapp +2348133385379. As We Dey Waka, No Be Lie. #wakacometv #toriaswedewakacome

Bobriski vs Nnegi

Image
Tori As We Dey Waka Come: This waka na on top 29 years old, Africa Barbie, Idris Olarenwaju Okuneye, a.k.a bobriski don yan say him no go dey help pipo again, say make them look as Nnegi wey just come out from, big brother house last year as her fans dash her range rover motto,    send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or whatsapp +2348133385379.

D'banj don welcome First daughter, 1st of January 2021

Image
Tori As We Dey Waka Come: Nigerian entertainer and businessman, Dapo Oyebanjo wey dey popularly known as D'banj don welcome di birth of him daughter - "babylet". D'banj share di news for Instagram as him describe him "babylet" as "gift from di heavens". D'banj call him wife for di post say she be strong woman, and e gbadun am as she take handle di pregnancy stage to born dia daughter.  send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or whatsapp +2348133385379. As We Dey Waka, No Be Lie. #wakacometv #toriaswedewakacome  

Covid19 vs poverty

Image
Tori As We Dey Waka Come: This na we program TalkAm, On Top  WakaComeTv. this na short videos of the CEO of waka come, on top one of him program way him call, TALKAM. make una send us pic or video of any matta way dey happen for una area as this waka dey go, we e-mail address na: wakacometv@gmail.com or inbox we FACEBOOK. ontop we page @ WakacomeTv Make una subscribe to we YOUTUBE channel: wakacomeTv #wakacometv #talkam #Talkam for more Tori As We Dey Waka. As We Dey Waka, No Be Lie.

HOUSE OF REP & NDDC

Image
Tori As We Dey Waka Come: Members of house of Representatives Dem don arrest NDDC Oga and him pipu, becuse say dem waka comort inside meeting for them front Members of the House of Representatives Committee on the Niger Delta Development Commission NDDC Dem waka arrest Managing Director of the Interim Management Committee(IMC) of the NDDC, Professor Kemebradikumo Pondei, wa waka comort infront of Dem today July 16. Pondei and his team were at the House to appear before the panel investigating activities of the commission. Recall that on Tuesday, July 14, a mild drama ensued at the committee hearing after Pondei failed to explain a N143 billion shortfall in the 2019 budget. Unable to answer the questions thrown at him by the Commission, Pondei asked for time to go back and address the N143 billion discrepancy raised by the committee members.  When he appeared before the house today, Pondei said he and his team members were not prepared to make any presentation be...