Posts

NLC 2021 strike: Nigeria Labour Congress [NLC] 'minimum wage protest' ahead of planned strike for all states in Nigeria.

Image
Tori As We Dey Waka Come: Nigeria Labour Congress protest' dey happun all over Nigeria, dis na ahead of dem planned strike action of dis government workers dem. As we dey waka come with dis planned strike wey dey hot right now for all di States inside we kontri Nigeria. Di umbrella labour union of Nigeria goment workers enta street yesterday wey bi Wednesday 10th of March 202 to protest ontop di matters wey dey affect dia members like minimum wage and oda tins. NLC protest for Abuja Unity Fountain As e dey hot for Abuja with Ayuba Waba National President, him lead di pipu to National Assembly building. Mr Ayuba Waba, wey bi National President of Nigeria Labour Congress say dem no happy wit how Nigeria lawmakers wan comot minimum wage matter on top di list. Di NLC leader say na sake of dis mata dem dey protest to show say dem no dey comfortable with dat arrangement and if goment no listen to dem, more protest and strike action g...

BREAKING NEWS: NNPC Gas Station Catch Fire For Akute

Image
Tori As We Dey Waka Come:  Inside dis picture una go see as pipo plenty dey try help to stop di fire wey happen today Saturday 6th of March 2021 dis morning. Dis fire start to dey burn for inside NNPC Gas Station, wey dey along alagbole, for Ore Meji Bus Stop, Akute Road Lagos State. Click on this, to see di videođŸ‘‡đŸ‘‡đŸ‘‡đŸ‘‡đŸ‘‡đŸ‘‡đŸ‘‡đŸ‘‡đŸ‘‡đŸ‘‡đŸ‘‡đŸ‘‡đŸ‘‡đŸ‘‡đŸ‘‡đŸ‘‡đŸ‘‡đŸ‘‡đŸ‘‡đŸ‘‡ NNPC GAS STATION CATCH FIRE FOR AKUTE VIDEO wakacometv.blogspot.com send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or whatsapp +2348133385379. As We Dey Waka, No Be Lie. #wakacometv #toriaswedewakacome

Governor Yahaya Bello Meet With President Muhammadu Buhari & OBJ for National Food Matter

Image
Tori As We Dey Waka Come: Nigeria Presido MUHAMMADU BUHARI waka come with OBJ and KOGI STATE GOVERNOR YAHAYA BELLO on top dis matter of Food dealers Strike, dis waka happen inside Abuja on Wednesday with Chief of Staff, Prof Ibrahim Gambari during a close door meeting wey go hellep solve dis suspension of Food. Di waka continue on Sunday inside Abuja, Kogi State governor, His Excellency, Yahaya Bello meet with the former president Olusegun Obasanjo Inside dis waka with di Chief Press Secretary to Governor Yahaya Bello, Mohammed Onogwu disclose. Him talk say di waka with former Nigeria president Olusegun Obasanjo dey alright, and E go hellep solve plenty matter. Di Chief Press Secretary to Governor Yahaya Bello, Mohammed Onogwu talk say, Former President Obasanjo don yan as e dey hot, on top security waka to di governor of Kogi State, make dem make effort to provide good security for Kogi state, and better information, to di pipo for security w...

(AUFCDN) Don Call Off Dia Nation-Wide Strike for we Kontri.

Image
Tori As We Dey Waka Come: Amalgamated Union of Foodstuff and Cattle Dealers of Nigeria (AUFCDN) don call off dia nationwide strike for we kontri. Di waka happen On Wednesday after dem yan di matter with di Federal Government wey dey represent by Kogi State Governor, Yahaya Bello. Di presido of AUFCDN, Muhammad Tahir, talk say dem decide to call off di strike after government promise to pay di N4.75billion dem demand as compensation, ensure protection of dia members and stop all forms of multiple taxation on di highways. Governor of Kogi State, Yahaya Bello bin don beg di Union to end di strike, as e promise to follow up and ensure say government meet di union demand. Tahir say: "All di stakeholders and members of AUFCDN in our nationwide strike dey glad say we achieve wetin we bin wan achieve. Since di Governor of kogi state, Yahaya Bello beg us on behalf of di government, we agree to call off di nationwide strike today. "Dem agree to pa...

Daniel Wilson Timeless Album: dis na new gbedu, wey just waka come outside, as e dey hot.

Image
Tori As We Dey Waka Come: We dey jolificate with we Nigerian Music Icon, for we industry, na Legendary Musician im be, we dey talk about our one and only Daniel Wilson, wey be king of RnB music, im don come out with dis Album wey him call am, TIMELESS. Dis na cool jam for old and young, na im oyinbo man dey call ever green music, di song dey sweet for body. Dis Album na 18 tracks wey dey totori person, as e dey hot. Track: 1. language barrier (feat. Abobi Eddiroll) Track: 2. Abortion (feat.BZB) Track: 3.  Good Old Days Track: 4.  The Virus Is Real Track: 5.  Mr Ragamuffin Track: 6.  Oyato' (feat. Gran-P & Obitunez) Track: 7. My Body Is Getting Weak Track: 8.  Heartbreaker Track: 9. 999 Track: 10. Children Of Africa Track: 11. One Naija Track: 12. The government You Deserve Track: 13. Jonathan Been Try Track: 14. Do Something Track: 15. The Youth Are Taking Over Track: 16. Personal Person (Feat. BZB) Track: 17. Foll...

Covid19: See Who Go Collect Di 3.92 Million Doses Qf Di AstraZeneca Vaccine Wey Just Enter Nigeria.

Image
Tori As We Dey Waka Come: Picture of di 3.92 million doses of di AstraZeneca vaccine wey just enter Nigeria. AstraZeneca vaccines don enter we kontri Nigeria, dis go make Nigeria di next West African kontri to collect di COVAX Facility after Cote d'Ivoire and Ghana. Di arrival of di vaccine go enable dem begin vaccinate Nigerians in priority groups, starting with di frontline health workers, na so NPHCDA talk. At all levels, di cold chain facilities wey dem go store di vaccine don dey ready. Mr Osagie Ehanire wey be di Minister of Health for we kontri Nigeria, don receive di 3.92 million doses of di AstraZeneca vaccine as e arrive di kontri capital, Abuja yesterday. Dem don dey train all di health workers wey go administer di vaccination, na so di National Primary Health Care Development Agency, yan inside statement wey di World Health Organization and UNICEF join body do. wakacometv.blogspot.com send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmai...

Covid19: Ghana President Nana Akufo-Addo and Him Vice President, Bawumia Go Receive Di First Dose of Di Covid-19 Vaccine

Image
Tori As We Dey Waka Come:  Ghana President Nana Akufo-Addo and him vice president, Bawumia go receive di first dose of di Covid-19 vaccine. For im yan, President Akufo-Addo him talk say,  dem go deploy di vaccines go 43 districts wey be di epicentres of di pandemic for Ghana, im yan say through di National Vaccine Deployment Plan, dem don segment Ghana population into four groups, and dis go determine which section of di population go collect vaccination at a particular time. 600,000 doses of di vaccine arrive Ghana on February 24, 2021, Ghana na di first African kontri for di world to receive di AstraZeneca vaccines from di COVAX facility. Ghana number one and number two citizens go take di vaccine together with dia spouse live on TV so as to encourage Ghanaians say di vaccine dey safe to take. wakacometv.blogspot.com send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or whatsapp +23481333853...

Sunday Igboho: DSS Waka Fail as Dem Try to Carry am.

Image
Tori As We Dey Waka Come: Security Agency, wey dem dey call DSS and  soldier try to arrest Yoruba activist Sunday Adeyemo Igboho, for road along Lagos-Ibadan expressway on Friday, february 26th 2021, him followers no allow dem to carry am as dem ready to protect dia leader. Di matter bi say Sunday Igboho bin go meet Yoruba socio-political group, Afenifere chief, Ayo Adebanjo wen di matter happen, as im dey go for road na him DSS and some Army block am for road. Sunday Igboho Media person yan say di matter happen around 2pm wen dem bin dey on dia way out of Afenifere house, two heavily armed military operatives stop dem come ask if Sunday dey inside di motor, na so wahala start, Sunday boys no allow dem to carry am. Inside did video una go see as Sunday follow dey parra, dem no allow DSS to carry any action. wakacometv.blogspot.com send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or whatsapp +2348133385379. As We Dey Waka, No Be Lie. #wakacometv #toriaswedewaka...

Zamfara kidnapping: Gunmen Abduct 300 plus Jangebe Government Secondary School Girls.

Image
Tori As We Dey Waka Come:  Di Zamfara state police command don confirm di abduction of 300 plus students wey gunmen kidnap from dia boarding secondary school early today for di town of Jangebe, for Zamfara state. Father of one of di kidnapped Jangebe students say: E dey pain me say I no follow go visit my pikin di last time. Father of one of di kidnapped students for Government Girls Secondary School Jangebe don share im pain and how E feel wen news of him daughters kidnap reach im ear. Mohammed Rilwanu talk say two of im daughters dey among di 300 plus students wey gunmen kidnap from Government Girls Secondary School Jangebe on Friday the 26th. E talk say since di news of di daughters kidnap reach am, for hours now wetin dey im mind na how e no follow go visit dem last month during di school visiting day. Him bin receive phone call about wetin happen for di school around 1:45am till 3am and by di time im reach there some parents don dey there but by...

Promo! Promo!! Promo!!!

Image
Awoof Awoof Awoof!!!! E no de purge belle... Dis na ogbonge awoof promo for everybody way dey into music, waka come Tv don waka come with better awoof wey go hellep you wey be musician to get ogbonge musical video with 4K camera and better jolification waka on top dis matter now, with just 600,000 six hundred thousand naira, you go shoot standard MTV/SoundCity/TraceTv, musical video quality plus 1month promo on top one of dis Tv station, e never finish o!!! Plenty ogbonge media promo follow waka ontop dis matter. Di number to call na 08133385379                             .............................English..........................   Shoot a music video with 600K six hundred thousand naira, and get 1 month free promotion on any of this musical Tv station like MTV/SoundCity/TraceTv and more. guess the amazing thing, you are shooting on 4k, not 2k, 2.5k b...

Orlu crisis: Nigerian Army send helicopter go Orlu.

Image
Tori As We Dey WakaCome:  Military dey do air strike for Orlu as we dey see inside dis video Nigeria Military helicopter go Orlu town, for Imo State, southeast of Nigeria. Three weeks ago, jaguda pipo do shooting for di area kill pipo and burn some houses. E dey on top all social media for Nigeria on top dis matter wey dey hot for Orlu, some local tori pipo dey report say Nigeria Military dey conduct air strikes for Orlu as dem dey try catch members of Eastern Security Network (ESN). Different video of this matter dey sup on top twitter, Instagram and Facebook.   Helicopter fly pass dem as e fly out of di view of di video you fit hear gun shot. One man voice dey shout, "ha! Jesus Christ o! wia dis one dey? Ha! Why dis pipo dey waka upandan abeg? Why dis pipo dey… Jesus see gun. Ha!... make everybody enta... See di video: wakacometv.blogspot.com send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or whatsapp +2348133385379. As We Dey Waka, No Be Lie. #wa...