Obodo Oyinbo Museum Wey Waka Come Carry Ghana Gold For Asante Don Yan Say Dem Go Like Borrow Am Back From Asante Palace
Tori As We Dey Waka Come: Di ruler of Ghana Asante pipo don ask British Museum to return gold items wey dey dia hands to im kontri. Di Asantehene, Otumfuo Osei Tutu II, recently meet di museum director Dr Hartwig Fischer for discussions. Di items wey dey di museum hand include work wey di British take from Asante palace for Kumasi during war wit di British for 1874. Di British Museum tell tori pipo say im dey "explore di possibility of borrowing di items" to Ghana. Di Ghana ruler meet Dr Fischer last week, afta im di Coronation of King Charles. Ghana goment don set up Restitution Committee to torchlight di returning of items wey dem take from Asante Palace wey now dey for different pipo and institutions hand around di world. Nana Oforiatta Ayim, wey dey di committee, tell tori pipo say: "Dis objects na mainly sacred ones and dia return no be just about restitution. Na also about reparation and repair, for places wia dem from take dem, but also di pipo wey do di taking....