Posts

Uganda Bobi Wine Under Home Arrest & Out Of Food.

Image
Tori As We Dey Waka Come: After Di announcement about Di election wey dem do for Uganda, pop star Bobi wine, waka yan press pipo about di magomago and wuruwuru wey happen on top this election. Him yan say, na lie lie result and him no go accept am, say Yoweri Museveni no be him presido. Just after him yan dis matter for him house, na him soja plenty stand in front of him house, dem no allow any body to enter again to go see Bobi Wine, and him no fit come outside to see anybody, dis one na house arrest dem give am, soja jump enter Bobi Wine house, when him wife dey try plug fruit wey dem go chop, as food don finish inside house for dem to chop, di soja no allow bobi wine wife to plug di fruit, now Bobi Wine dey cry out to pipo to helep chook mouth inside Dis matter, as food don finish inside house, and dem no allow dem to come outside. 76 years old Yoweri Tibuhaburwa Kaguta Museveni, wey don be President for Uganda since 1986, don waka put him self again as the presido of Uganda, na ...

Covid19: We need 3months before schools go fit open back again, House Of Representative.

Image
Tori As We Dey Waka Come: School Resumption Stop, As House of Representative Dey ask for 3months before schools go fit open back again House Of Representative, don waka against federal Government wey talk say make school dem open Today wey be Monday 18th of January  2021. Di House Of Representative, Don fall federal Government hand on top Dis school opening  matter, Dem say coronavirus don come up, Dem talk Dis inside book say, coronavirus Dey very dangerous and E Dey kill pipo, Dem no go fit agree make school open inside dis coronavirus. Na on Saturday 16th, 2021, Dem write on top paper give Prof. Julius Ihonvbere, wey be Di chairman of House Committee, on top Basic Education and service, inside Dis Paper dem yan say, make dem check how coronavirus dey kill pipo, dis na di second wave, e be like say dem dey play on top dis coronavirus, because school no suppose open now, we school never ready to open at all, coronavirus no sabi small pikin, E dey kill plenty pipo everyday. Di...

4 Tips way go help you on top your NIN/Simcard/Bank acount

Image
Tori As We Dey Waka Come: 4 matter wey fit make you enter wahala.  Number 1: no use your face and information to go helep any body, to register sim card, or else the person go use the sim do magomago, na you go enter wahala. Number:2 As the matter be now way your account details don dey together with your phone, no let any one use am make call again for your back. If the person use your phone call, dem fit do magomago. Number:3 No allow any body use your phone browse, make dem no go login to any social media account, if dem log in, dem go fit use am get into your bank account. Number:4 From now make sure say you no dey share your phone with any body, because e don be like your ATM and BVN now. Abeg share this tori give everybody. Dis na security information wey go helep you on top your NIMC wey connect to your bank account and your sim card.                     ...

NIN blame network for delay of registration

Image
Tori As We Dey Waka Come: As we carry waka enter NIN office, we yan with one of Di staff, him yan say, no be small job everyday, plenty pipo go come for registration and after some time, network go bad, na him make dem to dey shut down, dis matter dey make pipo vess, and di Queue dey long well well. We yan with one of di pipo on top dis long Queue, her name na madam chioma. Madam chioma yan on top how she take do her Registration waka, inside NIN office for Abuja. Madam chioma: Dem say make I come back next month after them don give me number inside paper say na him dem go use attend to me, the crowd dey plenty, as early as 8am, pipo don full plenty for long Queue every day, but after 3pm dem go yan say dem wan shut down, say di network no dey work well well again, na till di next dey be that, dis na wetin my eye see, on top dis NIN registration, no be small matter. www.wakacometv.blogspot.com send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or whatsapp +2348133385379. As We ...

Uganda: Election in Chaos

Image
Tori As We Dey Waka Come: Today Na Election day For Uganda, but plenty pipo dey fear to come outside come vote. The matter dey hot as Uganda government don shot down internet for Uganda. No be small waka as Bobi wine wife, dey show inside wan video wey go viral, as Di Government security officer dey bit am. Uganda youths dey para, na him make dem wonder if International criminal Court  (ICC) dey work.  Today wey be 14th of January 2021, Election don start inside Uganda, Di Government don shut down internet and wahala dey happen every where. www.wakacometv.blogspot.com send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or whatsapp +2348133385379. As We Dey Waka, No Be Lie.

Bone Straight hair and why e dey very expensive.

Image
Tori As We Dey Waka Come: Inside Dis video on top we youtube channel wakacomeTv, you go See as di matter dey sup ontop dis Bone Straight Hair, and why e dey very expensive to buy. Many women for we kontri, don buy this hair to fit follow do Yanga and shakara, dis no be small wahala for lady wey no get money to buy this hair. www.wakacometv.blogspot.com send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or whatsapp +2348133385379. As We Dey Waka, No Be Lie. #wakacometv #toriaswedewakacome https://youtu.be/wzAyOT1jKuY

America government should copy from Nigeria in Democracy.

Image
Tori As We Dey Waka Come: Dis na why we before before presido, oga GoodLuck Jonathan, Be peace, Ambassador. After di 2015 election, oga Jonathan accept defeat and him congratulate him opponent.   Na 2011 be di Di First Election, wey dem elect Oga Jonathan as Vice President, den him kon enter as president after him sitting President wey be Umaru Yar'Adua pai. Oga Jonathan waka to enter for presido office again, but di waka no work as him opponent wey be  Muhammadu Buhari, defeat am for 2015. Oga Jonathan since den don dey waka go many African kontri for peace mission and election observation across Africa. One of him new appointment na with ECOWAS, wey dem send am go Mali. www.wakacometv.blogspot.com send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or whatsapp +2348133385379. As We Dey Waka, No Be Lie. #wakacometv #toriaswedewakacome

Covid19: UK Close Airport on lockdown.

Image
Tori As We Dey Waka Come: Coro dey disturb UK no be small, as dem don start to dey check who and who go fit enter dem Kontri Last week na him di Prime Minister yan say di government dey on national lockdown. "From 4am on di 15th of January 2021, we go dey introduce pre-departure testing requirements for every body wey dey waka enter England. All di pipo wey dey waka come on top water, and railway, dem go get prove say dem no get covid19, dis pipo go don do test 3days before dem start to take come UK." Di advice wey dem get for pipo wey dey torchlight how dem go take waka enter UK, make dem sidown for house, make dem no plan to do any waka at all. www.wakacometv.blogspot.com send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or whatsapp +2348133385379. As We Dey Waka, No Be Lie. #wakacometv #toriaswedewakacome

Uganda:76 years old Yoweri Museveni go challenge 38 years old Bobi Wine.

Image
Tori As We Dey Waka Come: Uganda Elections: Na On Di 14th of January 2021, 76 years old Yoweri Museveni go challenge 38 years old Bobi Wine.   38 years old Robert Kyagulanyi Ssentamu, wey dem dey call, Bobi Wine go waka do election with 76 years old Yoweri Museveni wey don use 35 years for office as presido. Uganda pop star Bobi Wine, wey wan unseat President Yoweri Museveni, talk say na so Di man dey use all him Government security officials to disturb him supporters, Bobi wine yan dis matter give International Criminal Court(ICC). Plenty Pipo dey dress in red, to support Bobi wine wey dem also dey call di ghetto presido. As e be so, Facebook don block Di Accounts of Uganda Government officials. www.wakacometv.blogspot.com send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or whatsapp +2348133385379. As We Dey Waka, No Be Lie. #wakacometv #toriaswedewakacome

ASUU waka on top Covid-19

Image
Tori As We Dey Waka Come: Some staffs for UNILAG carry waka on top covid-19 yesterday on Sunday, after dis waka, dem say di skul never ready to open. ASUU waka yan say, dis Corona Virus, don pai pipo and Di matter don come Up to 99,063 and 1,350  on Saturday. Universities across Nigeria go begin get ready and prepare to return to school from di 18th of January, 2021. Dis na sake of say various school management don dey set time wey new academic session go begin for dis year 2021. www.wakacometv.blogspot.com send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or whatsapp +2348133385379. As We Dey Waka, No Be Lie. #wakacometv #toriaswedewakacome

Osun State Police, Don Catch Ritualists.

Image
Tori As We Dey Waka Come: Ritualists don confess to Police Command Osun State, say dem dey strangle pipo to death wey dem catch to do ritual. Di Osun State Police Command catch some ritualists, wey confessed say dem dey kill pipo dey sell part of di body. One of dia customer wey olopa catch, him name na Lukman Garuba, him confess say, him dey buy human body part, from dis ritualist, for N2000. Na inside Iwo, for Osun State Police catch 31 years old Garuba, dem arrest am for di place wey dis ritualists’ dem dey do dia evil work, inside town with Tajudeen Monsuru, and dem also 25 years old Hamsat Akeem, him follow confess say dem follow waka to pai one person wey him name na Akanbi Adeolu. One Monsuru confess say him kill him girlfriend, Mutiyat Alani and Akinloye Ibrahim and many other pipo.  Di Osun State Commissioner for Police, Wale Olokode don talk say very soon dem go catch all dis bad pipo wey dey do kidnapping, cultists, and drug dealing dem. www.wakacometv.blo...