Posts

Covid-19 Second Wave: Olympic Agency Dey Fight Japanese Government over Tokyo 2020.

Image
Tori As We Dey Waka Come: Di Deputy Chief Cabinet Secretary don deny sey dem cancel di Olympic Game, dem say na coronavirus wey dey worry dem, make dem talk like dat, dem say dem dey arrange for di year 2032 Olympic game for Tokyo, by that time coronavirus no go dey, Japanese Government don cancel Olympic Games wey suppose start on Di 23 rd Of July. Anoda Tori wey reach us be say, Di Japanese government talk say, pipo dey kpai ontop Dis coronavirus every day, so dem no go fit allow dis game waka come, dem go stop am till, 2032. Organisers dey parra dey say di game must happen inside dis coronavirus, dem say di Tokyo Olympic Game go open dis year, make di government try understand. Osaka Mayor Ichiro Matsui don talk say, make dem look as dis second wave of coronavirus dey kill pipo anyhow, say e go good if dem change di date till 2024, because of dis coronavirus.   www.wakacometv.blogspot.com send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or WhatsApp +2348133385379...

Ondo State give herdsmen 7days to waka comot for di state.

Image
Tori As We Dey Waka Come: Inside Akure yesterday, plenty pipo waka come outside to support di matter wey governor talk. Governor of Ondo state, yesterday talk sey E give headsmen 7days, make dem waka comot from Ondo State, and forests. Governor Oluwarotimi Akeredolu don order Say make all dis herdsmen dem comot from bush inside forest for Ondo State, dem say dem no wan see dem at all, him don give dem 7days make dem waka. Di pipo of Ondo State, happy with dis good decision wey Governor yan, Di Chairman of the National Union of Road Transport Workers, Comrade Jacob Adejo sef talk about how dis herdsmen dey kill pipo, him say road no dey safe again because of dis herdsmen dem. www.wakacometv.blogspot.com send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or whatsapp +2348133385379. As We Dey Waka, No Be Lie. #wakacometv #toriaswedewakacome

US President 1st day inside office cancel Nigeria and some kontri from Ban

Image
Tori As We Dey Waka Come: On Wednesday wey be 20th of January 2021 Donald J. Trump colourr for White House. Joe Biden don waka enter White House, As di new President of di United States of America. Today wey bi 21th of January him yan on top paper, one of di waka wey him go like change, as di new president. Today wey go bi him first day inside office, Joe Biden don cancel all di ban wey former US President give, as di matter dey sup now, all di kontri wey Trump no allow to enter US go fit enter now. Di name of di kontri wey go fit travel go US now with out wahala na, Nigeria, Eritrea, Yemen, Sudan and some kontri. Dis wan go dey for history say black woman enter power as vice president of di United States of America yesterday, when dem put dem for office. Di new president wey enter office on Wednesday, yesterday wey bi 20th of January 2021, as di President of di United States of America, him name na, Joe Biden and him vice president na black woman, her name na Kamala Harris, Dis...

Vice Principal Rape, 12 years old girl in kastina.

Image
Tori As We Dey Waka Come: Vice principal arrested for impregnating 12-year-old student in Katsina. Police don arrest One Vice Principal of one secondary school for impregnating one of the students for the school. Dis matter happen for Rimi Local Government Area of Katsina State, the teacher name na Ibrahim Tukur. E get one secondary school for Rimi Local Government Area inside Katsina State, na him one Vice principal Ibrahim Tukur, give small pikin wey be student of di school, belle. Police don arrest this Ibrahim. Presently, the girl wey him give belle na 12 years old pikin, and dis 12 years old girl don born di pikin. Ibrahim Tukur and him padi wey dey do dis bad thing, police don catch all of dem on Wednesday, dem dey inside Kastina Police Command headquarter www.wakacometv.blogspot.com send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or whatsapp +2348133385379. As We Dey Waka, No Be Lie. #wakacometv #toriaswedewakacome

Woman Die With Her Baby For Road Yesterday

Image
Tori As We Dey Waka Come: Dis wan happen yesterday 20th of January, Inside warri Delta State, as police dey waka with motor to catch yahoo boys, dem kon go jam one keke wey carry passenger of one woman and her small pikin, for road on top high way, dis woman and her pikin kpai instantly. Dis wey dey painful so, happen for PTI junction inside Effurun. Di police wey jam dis woman and her pikin, na from Ebrumede police station dem come from. Di pipo wey use eye see the matter no happy at all as di woman and her pikin die,  dem burn police motor wey jam dis woman inside keke, dem even block road. www.wakacometv.blogspot.com send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or whatsapp +2348133385379. As We Dey Waka, No Be Lie. #wakacometv #toriaswedewakacome

FG Don Waka Come, To Help Give Pipo Time For NIN Registration.

Image
Tori As We Dey Waka Come: Federal Government don give time, for we  pipo to fit waka on top we SIM card with NIN, FG talk say as di time no plenty for we pipo to fit do dis waka, dem don add time to am, di matter wey dem yan before bi say e go stop yesterday, wey be 19th of January 2021, now federal government don give everybody time till next month, on di 9th of February 2021, dis na good news for everybody wey never waka go do him registration.   Di  mobile network operators (MNOs) pipo don yan about di matter wey make Federal Government give we pipo time, dem talk set make we pipo self try waka come for registration, because na 9th of February go be di final closing time. www.wakacometv.blogspot.com send your Tori, to we E-mail: wakacometv@gmail.com or whatsapp +2348133385379. As We Dey Waka, No Be Lie. #wakacometv #toriaswedewakacome

Di Man wey deny baby mama, need baby son back.

Image
WakaCome Tv Abeg hide my identity, 14yrs ago, e get one geh wey dey our area and every guy for the area know say she be losed geh and she just dey open legs for guys anyhow. During that time me sef come say make I go catch my own cruise, na so she come tell me say she don get belle from the kind play wey we play. But I deny am flat since no be only me dey sleep with her. After she born, the pikin resemble me well well but i still deny the baby. Six years ago I come marry, my wife don get two children for me and the two of dem na girls. The second belle wey my wife bin born na by the grace of God she survive bcos she get serious complication and Doctor say after that birth, she no go fit born again. Now as the mata be, na girls I get but I no get baby boy, I come go meet that lady wey bin born for me bcos na boy she born. Wen I reach dia house, she don marry and her family don officially adopt the baby as dia own. Dem pursue me say make I no ever come the house again and say I no get an...

Water Don carry pipo go for Burundi

Image
Tori As We Dey Waka Come: Inside, Burundi heavy rains don carry waka plenty pipo property, dis water don cover thousands of pipo house. Di Gatumba, Mutimbuzi region located 5km from Bujumbura province don suffer from heavy floods, since Monday January 11, dis one happened after di Rusizi River wey be di tributary lake for Tanganhika, vess comfort come out side on cover this community with pipo house, di pipo don dey cry for movement make dem helep dem build back dier property, eye water don carry waka. One of di pipo wey dey cry for help, yan say dem dey beg di movement, make dem help dem block dis River wey don carry water cover dier community. Di National Platform for Risk Prevention and Disaster Management talk say make all di pipo comfort pack comfort go another place, till di time wey dem go fit solve di matter. Dem yan say dis na di second time wey dis water go waka cover pipo house and road, say dis matter don happen before for may 2020, wey E carry plenty pipo propert...

Uganda Bobi Wine Under Home Arrest & Out Of Food.

Image
Tori As We Dey Waka Come: After Di announcement about Di election wey dem do for Uganda, pop star Bobi wine, waka yan press pipo about di magomago and wuruwuru wey happen on top this election. Him yan say, na lie lie result and him no go accept am, say Yoweri Museveni no be him presido. Just after him yan dis matter for him house, na him soja plenty stand in front of him house, dem no allow any body to enter again to go see Bobi Wine, and him no fit come outside to see anybody, dis one na house arrest dem give am, soja jump enter Bobi Wine house, when him wife dey try plug fruit wey dem go chop, as food don finish inside house for dem to chop, di soja no allow bobi wine wife to plug di fruit, now Bobi Wine dey cry out to pipo to helep chook mouth inside Dis matter, as food don finish inside house, and dem no allow dem to come outside. 76 years old Yoweri Tibuhaburwa Kaguta Museveni, wey don be President for Uganda since 1986, don waka put him self again as the presido of Uganda, na ...

Covid19: We need 3months before schools go fit open back again, House Of Representative.

Image
Tori As We Dey Waka Come: School Resumption Stop, As House of Representative Dey ask for 3months before schools go fit open back again House Of Representative, don waka against federal Government wey talk say make school dem open Today wey be Monday 18th of January  2021. Di House Of Representative, Don fall federal Government hand on top Dis school opening  matter, Dem say coronavirus don come up, Dem talk Dis inside book say, coronavirus Dey very dangerous and E Dey kill pipo, Dem no go fit agree make school open inside dis coronavirus. Na on Saturday 16th, 2021, Dem write on top paper give Prof. Julius Ihonvbere, wey be Di chairman of House Committee, on top Basic Education and service, inside Dis Paper dem yan say, make dem check how coronavirus dey kill pipo, dis na di second wave, e be like say dem dey play on top dis coronavirus, because school no suppose open now, we school never ready to open at all, coronavirus no sabi small pikin, E dey kill plenty pipo everyday. Di...

4 Tips way go help you on top your NIN/Simcard/Bank acount

Image
Tori As We Dey Waka Come: 4 matter wey fit make you enter wahala.  Number 1: no use your face and information to go helep any body, to register sim card, or else the person go use the sim do magomago, na you go enter wahala. Number:2 As the matter be now way your account details don dey together with your phone, no let any one use am make call again for your back. If the person use your phone call, dem fit do magomago. Number:3 No allow any body use your phone browse, make dem no go login to any social media account, if dem log in, dem go fit use am get into your bank account. Number:4 From now make sure say you no dey share your phone with any body, because e don be like your ATM and BVN now. Abeg share this tori give everybody. Dis na security information wey go helep you on top your NIMC wey connect to your bank account and your sim card.                     ...